BBC Pidgin of Wednesday, 25 March 2026
Source: BBC
Slavery na di "most dreadful crime wey hapun for di history of mankind", Ghana foreign minister tell BBC ahead of one landmark vote for di UN General Assembly.
Member states dey ready to vote on one resolution - wey Ghana lead - to recognise di transatlantic slave trade as "di gravest crime against humanity".
Di proposal ask UN member states to consider apologising for slave trade and contribute to one reparations fund.
Di resolution go likely face resistance, as states like UK for long don stand say dem no go pay for any reparations, dem say today institutions no fit dey responsible for past wrongs.
But di proposal advocates, wey include di African Union, say na step towards healing and justice.
Samuel Okudzeto Ablakwa, Ghana foreign minister, tell BBC Newsday programme say: "We dey demand for compensation - and make we dey clear, African leaders no dey ask for di money for themselves.
"We want justice for di victims and causes to dey supported, educational and endowment funds, skills training funds."
Ablakwa also say wit di resolution, Ghana no dey rank im pain above anyone else, but dem just dey document historical fact.
Between 1500 and 1800, dem capture around 12-15 million people for Africa and carry dem go di Americas wia dem dey forced to work as slaves. E dey estimated say ova two million pipo die on di journey.
Ablakwa tell BBC say di "structures" and " inequalities" wey slavery create still dey till today.
"Many generations continue to suffer di exclusion, di racism sake of di transatlantic slave trade wey don make millions dey separated from di continent and impoverished," e tok.
Ghana, wey be one of di main gateways for di trade, for long be leading advocate for reparations.
Forts, wia dem bin hold tens of thousands of enslaved Africans under inhuman conditions, still remain standing along di West African country coast.
Di resolution also call for di return of cultural artefacts wey dem tiff during colonial to dia countries of origin.
"We want a return of all those looted artefacts, wey represent our heritage, our culture and our spiritual significance. Dem gatz return all those artefacts wey dem loot for many centuries enta di colonial era," Ablakwa tok.
Ghana President John Dramani Mahama call di resolution "historic" plus "a safeguard against forgetting".

Ghana Foreign Minister Samuel Okudzeto Ablakwa tok say di resolution na about getting justice for di victims of di slave trade