BBC Pidgin of Wednesday, 25 March 2026

Source: BBC

Mohammed Sallah: Wia next for di Egyptian King as e dey comot from Liverpool

Mohamed Salah don dey end im career as Liverpool player Mohamed Salah don dey end im career as Liverpool player

Mohamed Salah don dey end im career as Liverpool player afta e announce say e go leave di club for di end of dis season.

Di Egyptian King don spend nine years for di Reds, play 435 matches for dem, win six major trophies including di English Premier League and Champions League, and score 255 goals, wey make am di third-highest goal scorer of all time for di Anfield boys.

Salah still get opportunity to wear di Liverpool jersey at least 15 more times dis season, but di question wey im fans dey ask now na wia e fit go next?

Saudi Pro League, MLS or Turkish League?

Football sabi pipo tok say di ogbonge issue wey fit pose wahala for Mo Salah to join top clubs for Europe na im huge wage bill of £20.8 million per year or £400,000 per week.

Clubs wey fit pay dat amount for a 34-year-old winger no plenty. But di amount no go go be problem for di big spending clubs for di Saudi pro league.

Tori be say Salah bin come close to going to Saudi Arabia afta di 2025 season, but e later renew im contract wit Liverpool.

Now, e sure say plenty clubs go still dey interested to sign am, especially wen e be say Salah dey considered as di most popular footballer for di Arab-speaking world.

Rumours don already dey circulate say e fit join Al-Hilal wia former Italian legendary striker Simone Inzaghi be dia coach.

However, oda big clubs for di Saudi Pro League like Al Ittihad, Al Nassr and Al Ahli also dey interested in di Egyptian winger.

In 2023, Al Ittihad bin make verbal offer to sign Salah for £150 million, but e reject di deal. Also, Hilal bin wan sign Salah to replace dia former super star striker Neymar, but e also no work.

Also, sake of say na devot Muslim, di prospect to play for Saudi Arabia, wia di holiest site for Islam dey, fit entice Salah to make di move.

Asides from moving to di middle east, chance fit still dey for Salah to remain for Europe as Turkish giants Galatasaray bin don make dia intention known say dem want am for dia side.

Wen Salah start to dey get gbas-gbos wit di current Liverpool coach Arne Slot, Galatasaray take dat opportunity to open dia door and tell di Egyptian say dem go welcome am if e decide to leave England.

And dia offer no be anyhow offer in terms of moni. According to Spanish newspaper Fijaches, di deal wey dem offer Sallah dey between $20 and $22 million annually plus oda perks like sponsorship deals, including a guaranteed starting role for di club.

Tori tok say oda big clubs for Turkey wey get deep pockets, like Fenerbahçe and Beşiktaş, also dey interested for di Egyptian.

Football sabi pipo say Salah fit dey inclined to consider dis offer bicos e go mean say e go remain for Europe competing for di Champions League wey be di most prestigious club football competition for di world.

Den, e still get opportunity to move to di Major League Soccer for di United States of America, wia di legendary Lionel Messi and Mo Salah former teammate, Luis Suarez still dey play active football.

Messi bin move to di MLS in 2023 to join Inter Miami, despite say clubs for di Saudi Pro League bin offer am outrageous amount of money to join dem. Dis move bin increase di reputation of US football and also attract oda big names.

Only recently, French international and World Cup Winner, Antoine Griezman, announce say e go join MLS club Orlando City wen e leave im current club Atletico Madrid for di end of dis season.

Oda top European players wey join di MLS as dem comot from Europe recently na di South Korean, Heung-min Son, wey leave Tottenham Hotspur to join di Los Angeles FC, and German legend Thomas Muller wey join di Vancouver Whitecaps afta e comot from Bayern Munich.

So far, fingers don dey point say San Diego FC fit make move for Mo Salah, especially based on say di owner of di club na one Egyptian-British billionaire, Mohamed Mansour.

Speculations also dey say Salah fit move di Chicago Fire who bin don make move for am bifor, and dem still retain interest to sign am.

Salah best moments for Liverpool

Liverpool fans no go eva forget Mo Salah and wetin e do for di Anfield side right from im first season wit di club.

Afta e join Liverpool from AS Roma in 2017, Salah finish im first season for Anfield wit 32 goals in 36 league matchws, plus 11 assists, and e finish as di top scorer for di league.

Dat 2017/2018 season, Liverpool finish for di fourth position and reach di final of di UEFA Champions League, wia e leave di field in tears afta Sergio Ramos bin dislocate im shoulder for one bad tackle like dat.

But for di next season, Salah carry Liverpool reach anoda Champions league final, and dis time, e score penalty as dem beat Tottenham to win di trophy.

Di very next year wey be di 2019/2020 season, Salah score 19 goals as Liverpool win di English Premier League wit seven matches remaining. Dat victory end Liverpool 30-year waiting for di EPL, even though fans bin no dey for di stadiums to celebrate am sake of di Covid19 pandemic.

Since Salah sign for Liverpool reach now, nobody don score more Premier League goals (189) or assists (92) dan im. And for di all time EPL goal scoring record, Salah dey number four (191), afta Alan Shearer (260), Harry Kane (213) and Wayne Rooney (208).