BBC Pidgin of Wednesday, 25 March 2026

Source: BBC

'E like di fear wey e see for our eyes', survivors of Epstein tell BBC

Lisa Philips on a boat with Epstein island for di background Lisa Philips on a boat with Epstein island for di background

Joanna Harrison bin no wan tok about di abuse she face for convicted sex offender Jeffrey Epstein hand.

Like many survivors, she say Epstein assault fill her wit shame and embarrassment. But afta her name come unintentionally dey public during di release of millions of files by di US govment, she tell BBC Newsnight Victoria Derbyshire say she feel say she gatz tok her mind.

"E get to a point wia you dey suffocated and you need to breathe, and I feel say dis na my way of trying to breathe," Harrison tok.

BBC Newsnight bring Harrison and four oda Epstein survivors togeda for di first time in di same room. During di hours-long discussion wey follow, E bin show support and, as dem study photos of demsefs from di time wen dem first meet Epstein, dem cry.

For di interview, di survivors tell dia stories of grief and anger. Some revisit Epstein private island, Little St James, while odas recall "fear-fear" moments for im New Mexico ranch.

Dem say dem believe say di powerful figures wey im bin dey associate wit go most likely know wetin bin dey go on.

Survivor identity pushed into spotlight

Millions of documents wey dey related to di different investigations of Epstein bin dey released by di US Department of Justice, but some of di unredacted material fail to cover di identity of im victims.

Harrison na one of those pipo wey dia name bin dey exposed to di public.

She tell BBC Newsnight say she bin no want di files to dey released, for fear say she go lose her anonymity.

"E no dey normal to see your abuser face evri day for six years on TV," Harrison tok.

She recall meeting Epstein for Florida wen she bin dey 18, and like oda survivors, she say evritin begin with a massage.

"Evritin look normal," Harrison tok. "Wen im begin to masturbate, I completely freeze. I no think I tok two words for di car during di ride home."

She later recount how Epstein rape her on im birthday.

As she tok publicly for di first time, Harrison say she doubt say she and oda survivors go eva get justice now wey Epstein don die. "I get questions wey I no go eva get an answer to."

Five kontris in five days wit Clinton, Spacey and Maxwell

Chauntae Davies share images wey pipo neva see bifor wit BBC Newsnight of her time wen she dey travel wit Epstein on im private plane to Africa.

Di pictures include Epstein co-conspirator Ghislaine Maxwell, actor Kevin Spacey and former President Bill Clinton. Spacey and Clinton bin dey travel on a humanitarian trip to promote Aids prevention.

"I describe am for my journal at di time as di most eclectic group of pipo wey you fit put togeda... e bin dey almost like a camp feel becos you dey travel to five different kontries in five days," she tok. On di plane dem eat snacks, play cards and tell tori.

"E bin dey very much like a once-in-a-lifetime trip, and unfortunately, e come dey tainted by wetin bin dey happun behind closed doors," she tok.

Davies don tok say she bin dey raped by Epstein for im private island after e hire her to give am massages.

Di trained massage therapist recall during di Newsnight discussion say she give Clinton a neck and back massage for one airport for Portugal while di plane bin dey refuel.

At di time, she say she write for her journal say di former president bin dey humble, kind and charismatic.

Dem ask di former president about dis interaction with Davies wen e bin sidon for a deposition in front of di US House Oversight Committee for February. E tell di committee say e wish Davies bin tell am about Epstein wrongdoing.

But Davies say she no consider to tell Clinton: "I no plan to eva tok about dis wit anyone."

"Wetin im for do really? Im [Clinton] fit stop am?" Davies wonder about Epstein wrongdoing. "I guess we go neva know."

At one point, while in Portugal wit Clinton, Davies recall as e dey help di former president buy jewelry for im daughter, Chelsea.

Clinton don repeatedly tok say e no witness Epstein abuse. Im name don come up hundreds of times in di Epstein files. To appear for documents wey dey related to Epstein no imply any wrongdoing.

Spacey don publicly call for di release of all di Epstein files, say: "For those of us wit notin to fear, di truth no fit come soon enof."

Epstein 'eerie' New Mexico ranch

Earlier dis year, allegations show for justice department files about Epstein wey prompt di US state of New Mexico to re-open criminal probe into im Zorro Ranch.

Di state bin previously suspend di initial investigation into di ranch for 2019 following a request from federal prosecutors in New York.

"Dat na wia majority of di assaults happun. I get my darkest memories from Zorro Ranch," Davies tok.

Wen she recall wetin e feel like to dey dia, she tell BBC Newsnight say she bin feel "trapped".

"E get one kain cold, dark, eerie feeling in dia," Davies tok.

Lisa Phillips, anoda survivor wey tok to BBC Newsnight, echo dat sentiment about di ranch. "I remember say e be like 'dis place dey really creepy', e just get dat kain feel," she tok.

Davies say she believe say e get a lot more to uncover about wetin happun for Zorro Ranch.

'I like to get tins on pipo', Epstein tell survivor

Epstein love to brag about im well-connected and well-appointed friends, Davies tok.

She say e brag about lending money to Sarah Ferguson, di former Duchess of York. "E no be secret," Davies tell BBC Newsnight.

E get framed photos of Ferguson wit her former husband, Andrew Mountbatten-Windsor, and dia daughters for Epstein property, Davies tok.

Phillips, a fashion model at di time, also tok about Epstein connections to Mountbatten-Windsor and retell a story of her friend, wey neva tok publicly and wan remain anonymous, allegedly being instructed to have sex wit Mountbatten-Windsor.

She say her friend bin go Epstein Upper East Side New York City apartment for 2003 wia she bin dey directed to go into a room and have sex with a man wey she say bin be Mountbatten-Windsor.

Mountbatten-Windsor don consistently deny all wrongdoing.

Phillips tell BBC Newsnight say she later ask Epstein why e make her friend have sex wit Mountbatten-Windsor. She say Epstein lag come say: "I like to get tins on pipo."

"Im like di fear in our eyes," she tok of Epstein abuses. "I think e like say we bin dey frozen and scared and no know wetin to do, and I think e get off on dat."

For di Newsnight interview, Phillips call on di UK police to tok to her about wetin she know about her friend alleged assault and Mountbatten-Windsor involvement.

Mountbatten-Windsor bin dey arrested in February on suspicion of misconduct in public office. Di probe dey centre on accusations say e share confidential, sensitive information to Epstein while serving as a UK trade envoy.

Di survivors wey tok to BBC Newsnight say dem no believe say Epstein kill imsef.

"We know am, we know di kind of pesin e be," Phillips tok.

Dem find Epstein dead for im prison cell on 10 August 2019 while dem hold am for di Metropolitan Correctional Center, for New York, on sex trafficking and conspiracy charges ahead of trial.

E bin dey ruled as a suicide by di New York medical examiner.

'I no dey smile di same way now' - Epstein lasting impact

Jena Lisa Jones and Wendy Pesante both meet Epstein wen dem bin dey 14. Di women bin be friends den and, years later after surviving Epstein abuse, dem still be friends.

"Wen you go through sometin like dat so young e kind of spoil your reality for a long time," Pesante tok. "You no suppose get di mindset of a sex worker at 14."

At one point during di interview, all five survivors bin see photos of demsefs at di age dem bin dey wen dem meet Epstein.

"I no dey smile di same way anymore," Harrison tok, looking at di image of her 18-year-old self.

Phillips look at di photo of hersef in a light-pink cloth, on a boat, and realise say Epstein island dey for di background.

"I bin dey enjoy my life, and I no get any idea about wetin wan happen to me," she tok of herself in di image. "Dis no be wetin I look like wen I leave di island."


"I think im [Epstein] bin like say we dey frozen and scared and no know wetin to do," na so Lisa Phillips tok.



Ghislaine Maxwell wit actor Kevin Spacey, wey don publicly call for di release of all di Epstein files



Chauntae Davies wit di former US president on a plane



Chauntae Davies say she bin dey raped by Epstein for im private island after e hire her to give am massages