One popular preacher for Ghana, Prophet Bernard ElBernard Nelson-Eshun say he dey "step back from public preaching and pulpit ministry" afta im failed political prophecy.
Prophet ElBernard bin prophesy say one candidate Kennedy Agyapong go win di opposition new patriotic party (NPP) presidential primaries.
He put im ministry on di line wey he tok say nothing go fit stop di businessman Kennedy Agyapong from winning di elections against di former vice president Dr Mahamudu Bawumia.
Pollsters and political researchers ahead of di 31 January election, tok say di ex-vice president dey for comfortable lead to win di primaries.
Some oda prophets also tok di same tin say Dr Bawumia wey lose di 2024 elections to di govment party candidate John Mahama, go win di primaries and lead di NPP for di 2028 election as dia candidate.
On top one local radio station Asempa FM, Prophet Bernard ElBernard explain say "I dey put 27 years of hearing from God, 18 years of pastoring di church on di line say Kennedy Agyapong go win di presidential primaries of di opposition party."
He add say, "I see for di spiritual realm dat be why I dey tok say Ken go win. Wetin I dey tok be say Ken already win di primaries wey he dey prepare to face di govment party NDC for di 2028 elections."
In fact, he even write book wey get one chapter about di prophecy and how di 65-year-old former MP, Kennedy Agyapong go win di election.
Many pipo shock about di way he put his ministry on di line wey he tok say dis candidate go win, when every bodi sabi say di former Vice President Dr Bawumia be di favourite to win di vote.
Afta voting across 333 polling centres across di 16 regions of Ghana on 31 January, Prophet ElBernard im candidate neva win.
According to di electoral commission, di former Vice President Dr Bawumia win wit 56.4% of di vote wey Kennedy Agyapong get 23.7%.
Di three oda candidates - Dr Bryan Acheampong get 18.5%, Dr Yaw Osei Adutwum get 1.02% wey Kwabena Agyei Agyepong get 0.2%.
Prophet ElBernard apologise afta di election
Few minutes afta di votes confam say Dr Bawumia win, Prophet ElBernard issue public statement wey he apologise for di "inaccurate" prophecy.
"Dat word no come to pass. I miss am. I be wrong. I dey sorry wey I dey ask for your forgiveness," Prophet ElBernard tok.
He add say, "sake of I tok for public wit prophetic authority, many pipo trust wetin I tok, wey dem dey affected emotionally, spiritually and politically."
"I take full responsibility for dis prophetic word wey I apologise to everyone wey trust my word but las las, dem dey hurt and disappointed."
During Sunday service, Prophet ElBernard confam to im members say he dey take step back from public prophetic declarations.
"For di spirit of responsibility, I decide say I go step back from public teaching, preaching and pulpit ministry. Dis be to allow me to reflect, pray and get more time for how revelations gatz be."
He also tok di members say, "even though I dey step back from prophecy, I go still dey di background to pray, study and grow."
"I no go tok you my church members say make you leave di church or stay, but I go still dey around."
One prophet use cake and champagne celebrate fulfilment of his prophecy
Many pipo fire am say he be fake prophet wey odas tok say he for neva enta politics wit his prophecies.
On top social media, pipo call am out.
But odas too say make pipo forgive am sake of he take accountability of wetin he tok; no be everibody wey dey do dat kind tin.
On di oda hand, some pastors wey prophes y say di former vice president Dr Bawumia go win di presidential primaries, enta social media to celebrate.
One of dem, Prophet Emmanuel Worlasi of di Conquerors chapel international and his family celebrate di fulfilment of his prophecy wit cake and drinks.
Inside one video for dia house, Prophet Emmanuel Worlasi and odas dey sing and worship wit cake and champagne.
On top di cake, dem write "prophecy fulfilled".
Many pipo blast di man of God for dat, even though dem take down di video from his page, e still dey circulate for social media.
Profile of Prophet Bernard ElBernard
For his social media profile, Bernard ElBernard be prophet, forex trader and cryptopreneur.
He be founder of SpiritLife revival ministries for Accra wey dem dey focus for prophetic, faith and di supernatural.
ElBernard also be author wey publish many books.
He also be philanthropist, wey he dey use his ministry to support di needy and young pipo for dia business.
Prophet Bernard ElBernard also dey do mentorship programmes wey also get scholarship fund wey dey assist students for university.
For 2024, he dash one veteran gospel musician Edward Boateng brand new car, wey he offer scholarship to his children up to di university, afta di musician go viral wit im financial problems.
Di video of di musician wey dey roam for bus stations and markets dey sing wey he dey sell pen drive of his songs, touch di heart of di prophet wey he decide to support am.
Many young pipo dey go di SpiritLife revival ministries sake of wetin he dey do for humanity.
In di past, he make prophecies wey hapun including di one for 2024 say John Mahama go win di elections and become president again.
Ghana police service since 2021 dey warn men of God especially ahead of every 31 December watchnight service say make dem check dia prophecies, make dem no cause fear and panic.
Since dat time, di preachers dey take tins slow wey dem dey mind di tins dem dey tok for dia prophetic services.
Di presidency sef open desk say make prophets and oda spiritual leaders submit dia prophecies – di ones wey get national security implication, to di office for vetting.











