Former US President Bill Clinton and im wife Hillary Clinton, wey be former Secretary of State, don agree to testify for Congress investigation about late sex offender Jeffrey Epstein.
Dis one dey come few days bifor dem go vote whether to hold di couple for criminal contempt bicos dem first refuse to show face bifor di House Oversight Committee afta months of back-and-forth.
Bill Clinton bin sabi Epstein, wey die for prison for 2019, but e don deny say e know anytin about im sex crimes and tok say e cut off contact wit am about 20 years ago.
E never clear wen di questioning go hapun, but dis go be di first time former US president dey testify bifor congressional panel since Gerald Ford do so for 1983.
Di Clintons bin resist demand make dem appear bifor di committee, say dem don already give sworn statement about di "small information" wey dem get on Epstein.
Dem tok say di legal summons wey di committee send na "just plan to embarrass political rivals, as President Trump direct."
Di House Oversight Committee, wey Republicans dey lead, later approve measure to hold di Clintons for contempt late last month, wit support from some Democrats.
For Saturday, lawyers for di couple offer make dem give limited testimony, wey for centre around four-hour interview wit Bill Clinton. But committee chairman James Comer raise concern about di restrictions wey dey inside the Clintons' proposal.
For Monday evening, Bill Clinton deputy chief of staff, Angel Ureña, post for X confirm say di couple go appear bifor di panel.
"Dem negotiate in good faith," Ureña write to di House Oversight Committee. "Una no do so.
"Dem don tell una under oath wetin dem know, but una no send. But di former President and former Secretary of State go show. Dem dey look forward to set precedent wey go apply to evribodi."
Afta dat, dem announce say lawmakers go postpone consideration of di contempt resolutions against di Clintons. House Rules Committee Chairwoman Virginia Foxx say di Oversight Committee need more time "to clarify wit di Clintons wetin exactly dem agree to."
Comer too tok say: "I go clarify di terms wey dem agree to bifor I discuss next steps wit my committee members."
No survivor of Epstein abuse don accuse any of di Clintons of wrongdoing, and dem don deny say dem know about im sex crimes.
Epstein private jet logs show say Clinton take four international flights for 2002 and 2003.
Shortly afta dem arrest Epstein on sex trafficking charges for July 2019, Clinton spokesperson tok say di former president travel on di plane wit "stops connected to di work of Clinton Foundation."
Di former president still show for photos wey dem find at di late financier estate, among records wey di Justice Department release to follow a law wey Congress pass wey order make dem disclose all investigative materials related to di late convicted paedophile.
One picture show di former president dey swim inside pool, while anoda show am lie on im back wit im hands behind im head for wetin look like hot tub.
Ureña, Clinton spokesman, tok say dat time wey dem release di photos for December say di pictures don old, for decades, and Clinton don stop to associate wit Epstein before im crimes bin dey revealed.
Last month, di Clintons write one letter give James Comer, di chairman of di House Oversight Committee, wia dem criticize di way e handle di Epstein investigation.
"Di decisions you don make and di priorities you set as chairman on di Epstein investigation don block progress to uncover di truth about di govment role," di letter tok.
Dem add say: "No reasonable explanation dey for wetin you dey do apart from partisan politics."
Comer don earlier note say di subpoenas wey dem give di Clintons pass through bipartisan vote, and say "no one dey above di law."
"We don communicate wit President Clinton legal team for months, give dem chance again and again make dem come, give us just one day, but dem kontinu to delay, delay, delay," Kentucky Republican tok.











