Families of two students dey mourn for di Volta region of Ghana afta dia children die following one bee attack for dia school.
Oda students of di Evangelical Presby school injure during di attack as dem dey play during break time.
Parents of di four-year-old wey die dey shocked and devastated.
"Dis tin neva happun to me bifor; how I go recover from dis trauma? Make God help me," Mawuko Kumeko (mother of di child) tok as she dey cry when one native of di area - Freida Abla Amable and odas visit di family to console dem.
She add say "I carry my child go school wey I say make I go market wit di younger child, only to come back and hear say my boy die afta bees attack dem."
Di oda family wey lose dia nine-year-old daughter also dey struggle to come to terms wit di incident.
How e happun
Tori be say some of di boys dey play football under one tree for di school when dia football lock for di top.
As dem dey throw stones to comot di ball from di tree, dem disturb di nest of di bees for di school campus.
One journalist for di area Faisel Abdul-Iddrisu explain say "di bees attack di pupils and dia teachers wey some of di students also run away."
"Dem rush four students to di Anloga polyclinic bifor dem later refer dem to di Keta govment hospital – but officials confam say one of di students – seven-year-old, die on arrival," Faisel tok local network TV3.
Later anoda four-year-old boy also die, as two odas dey admitted for di keta municipal hospital.
"We check di state of di four students wey dem carry come our emergency – we see say two of dem dey critical; dia body system dey react strongly to di bee sting – we lose dem. But di two odas survive," Dr Fiifi Agyemang wey be medical officer for di Keta govment hospital tok for TV3.
E add say "di oda child get mild reaction so we discharge am on Thursday wey we get one more student wit us at di moment wey dey stable."
Meanwhile headteacher of di school oga Thywill Deynu say di bee attack especially di kindergarten children wey no fit escape.
"We call di fire service from di Anloga district during di attack wey dem come control di situation wey dem also secure di area," Citinewsroom quote am.
Local authorities say dem go destroy di bee nest for di campus afta dis latest incident, even as di school dey go on vacation for di Christmas festivities.
Three bee attack incidents happun dis week alone
On 13 December, bees attack and kill one farmer for di Akatsi North district of di Volta Region.
Anoda 82-year-old woman wey also suffer di attack dey critical condition according to di Ghana news agency.
Di pesin wey die for dat attack dey for her late 70s, according to di national disaster management organization (Nadmo) official for di area.
Di bees comot from one nearby baobab tree when one contractor dey reshape some road for dat area.
On 14 December anoda bee attack for Kpandai for di Northern Region of di kontri kill one pesin.
Tori be say di deceased wey be traditional leader dey on top motorbike dey travel when he suffer di bee attack.
Fire service dey deal wit bee-related incidents often
On 16 December, di kontris fire service relocate one bee swarm for Laribanga police station.
Di Damongo municipal fire command wey ADO II Issahaku Jalaldeen dey lead, "safely and professionally relocate di bees from di new Laribanga police station."
According to di service, no firefighter hurt during di operation wey dem no harm di bees in di process "to protect ecological balance ."
Earlier for 10 October 2025, di fire service for di Eastern region clear bees for one building for di cocoa board area.
Inside of statement, di fire service say "we dispatch fire tender to di scene wey we see say di bees comot dia hive wey dem dey try enta one glass shop."
"Di crew manage to control di situation without any damage to property, casualties or injuries to di public or di firemen. We also clear di swarm of bees completely," di Eastern region fire service tok-tok pesin add.
On 19 June 2025, di fire service for Begoro in di Eastern Region respond to distress call about bee invasion for di district health directorate.
Di crew "conduct swift assessment wey we manage di situation without any injures."
Di service say make di public call dem whenever dem discover any situation involving bee attacks.
Tips to prevent or escape bee attack
Wetin dey happun wen bees attack or sting pipo?
One medical doctor for Ghana, Dr Andrews Baha tok BBC Pidgin say "di bee sting fit trigger one reaction wey dem call anaphylaxis, especially when di pesin dey allergic to it."
He explain say "dis dey lead to difficulty in breathing sake of di airway of di pesin go dey blocked just like e dey during asthma attack, shock or even for cardiac arrest."
According to him "immediately pesin suffer bee sting, dem gatz to visit di hospital quick – sake of ibi life-threatening emergency."
"For di hospital, we go give di pesin medicine (epinephrine) to reverse di attack; we also go help di patient wit oxygen and IV fluids to reverse di shock den we monitor for any oda issues," Dr Baha explain to BBC Pidgin.
Experts say to prevent bee attack, pipo gatz to avoid using strong perfume, especially if you dey work or live around place wey get bees.
One tok-tok pesin for di Ashanti regional fire service department explain say bees no dey like noise.
ADO 1 Daniel Antwi Boasiako tok say "bees fit attack you if you disturb dia nest."
"Dem also no dey like body odour or strong perfume – dem fit attack you if dem perceive dis tins."
He also tok say "di swarm dey protect dia queen, so if you see plenty bees for one side, wey you throw stone or shake dia nest, dem go tink say you wan attack dia queen, wey dem go rather attack you."
"If one or two bees begin to attack you, e be sign say you gatz to leave dia area, otherwise di whole swarm fit descend on you."
ADO 1 Daniel Antwi Boasiako give dis tips:
Walk away from bees when you spot dem for any location
If bee land for your body, make you comot am gently, no do am aggressively
If one sting you, comot di area, no throw hands and swat at dem otherwise dem go
come at you
Make you no try to rescue any animal wey dey under bee attack if you no dey wear protective gear
Avoid heavily scented perfumes, lotion or shampoos if you know say bees dey a particular area
No throw stone to disturb dia hive/nest
If plenty bees attack pipo for one area – make dem rush go hospital

Families of di two deceased dey devastated by di tragedy

Di fire service dey receive distress calls to deal wit bee attacks for many parts of di kontri

Bees no dey like strong perfumes or scents wey dem no dey like to be disturbed

"Bee sting fit trigger one reaction wey dem call anaphylaxis, especially when di pesin dey allergic to it, wey dey lead to difficulty in breathing sake of di airway of di pesin go dey blocked" - Dr Andrews Baha











