President Donald Trump don suspend di US green card lottery scheme.
Dis dey come afta one mass shooting for Brown University last week wey lead to di death of two pipo.
Authorities find di suspect, wey be one Portuguese man dead on Thursday, 18 December.
E enta di US through di Diversity Lottery Immigrant Visa Programme (DV1) for 2017 and dem give am green card.
Homeland Security Secretary Kristi Noem tok say she don pause di visa scheme under Oga Trump direction to "ensure say no Americans go suffer again sake of dis disastrous programme".
US officials say dem believe say na di suspect, 48-year-old Claudio Neves Valente, also kill one Portuguese Massachusetts Institute of Technology professor Nuno Loureiro earlier dis week.
Why US suspend di program
Oga Trump order di Homeland Security Secretary Kristi Noem to suspend di program, few hours afta police discover Neves Valente deadi body for one storage facility for Salem, New Hampshire, from wetin police believe say na self-inflicted gunshot wound.
Police say video evidence and tips from di public lead investigators to one car rental location wia dem find di suspect name and match am to dia pesin of interest, afta one six-day multi-state manhunt.
Dem find am dead wit one satchel and two firearms. Evidence for one car nearby bin match go di scene of di shooting for Brown University for Providence, according to Rhode Island Attorney General Peter Neronha.
Brown University President Christina Paxson say Neves Valente enrol for Ivy League school from di autumn of 2000 to di following spring, and e bin dey study for a PhD in physics.
E "no get current active affiliation" to Brown, she tok.
Officials tok say dem believe Neves Valente shoot and kill MIT professor Nuno F Gomes Loureiro, 47, on Monday for im house for Brookline, wey be about 50 miles (80km) from Providence.
Wetin be di Diversity Immigrant Visa Program
Di programme dey make up to 50,000 visas available each year through one random selection process among entries from countries wit low rates of immigration to di US.
Dem launch am for di 1990s. Every year, millions of pipo dey apply for visas through di program.
To qualify for a diversity visa, applicants must get at least high school education or two years of work experience for field wey require training. E also dey compulsory for dem to undergo vetting and interview bifor dem fit get visa.
Na Congress create di program and e neva dey clear under which legal mechanism Madam Noem fit order suspension.
Di US State Department dey oversee most of di visas wey dey issued through di lottery programme, although, di U.S. Citizenship and Immigration Services dey process some parts of dem.
President Trump na long time critic of di diversity visa program, e push to end am during im first tenure, afta one man we yenta America via lottery kill eight pipo inside one truck accident attack for New York.
Supporters of di visas say dem dey vet recipients and di programme dey good for di US economy plus di kontri image abroad.
Trump suspend di program for 2020 during im first administration.
Wetin be green cards?
.Green cards dey give immigrants legal permanent residence and di opportunity to apply for American citizenship
.In a typical year, dem dey issue nearly one million green cards for di US
.Majority - roughly 70% - dey go to pipo wey get relatives wey dey live for US, according to one 2018 report from di US Senate
,For employment-based green cards, one common form of di residency status, roughly 80% dey issued to dos wey already dey di kontri, wey dey shift from temporary visa to permanent residence
The Brown University shooter, Claudio Manuel Neves Valente entered the United States through the diversity lottery immigrant visa program (DV1) in 2017 and was granted a green card. This heinous individual should never have been allowed in our country.
— Secretary Kristi Noem (@Sec_Noem) December 19, 2025
In 2017, President Trump…











