You are here: HomeAfricaBBC2023 08 11Article 1823294

BBC Pidgin of Friday, 11 August 2023

Source: BBC

Niger coup: Ecowas order deployment of standby force to restore constitutional order

ECOWAS leaders in a group photo after a summit in Abuja ECOWAS leaders in a group photo after a summit in Abuja

Leaders of West African regional bloc ECOWAS don order di activation of di Ecowas standby force for possible enforcement of dia resolutions for Niger wia a military coup bin comot President Mohamed Bazoum from power about two weeks ago.

For one communique wey dem read after dia emergency meeting for Abuja Ecowas Leaders say dem reach here after considering di reports of envoys and also carefully deliberating di proposal of ecowas defense chiefs as well as other submissions by the ECOWAS Commission.

Di Regional bloc say e go uphold all im resolutions and dat all options remain open. Dem mandate di ECOWAS leadership to continue di monitoring of di sanctions wey dem impose on di junta leaders and warn those wey dey hinder di peace process for Niger to stop am.

Di also come call on di AU, and di UN to support Ecowas for dia efforts to restore democracy for Niger

Earlier, Nigeria's President and Chairman of di bloc, say Ecowas gatz give priority to diplomatic negotiations and dialogue in resolving di political crisis for Niger.

E also note di roadblocks wey di previous envoys wey dem send go mediate wit di military Junta for Niger bin encounter.

"We gatz engage all parties involved, including di coup leaders, in earnest discussions to convince dem to relinquish power and reinstate President Bazoum. Na our duty to exhaust all avenues of engagement to ensure a swift return to constitutional governance for Niger." President Tinubu add.

Di ECOWAS Chair also note say di political crisis for Niger also pose a threat to di stability of di West African region.

Oga Tinubu express confidence say dis second summit on resolving Niger's crisis go be "defining moment" towards a "stronger, more resilient, and integrated West Africa".

We dey update dis tori