Millions of pikin dem and teenagers wey dey under di age of 16 no go get access to dia social media accounts again for Australia.
Dis dey come as di kontri don start di first ban for pikin for sicial media for di wold.
Instagram, Facebook, Threads, X, Snapchat, Kick, Twitch, TikTok, Reddit and YouTube dey among di platforms wey must to enforce di new laws.
For di new law, deM no go punish pikin or dia parents, if dem break am ooo, na di companies go collect. Di punishment na fines wey fit reach up to A$49.5m (US$32m, £25m).
Di goment say di ban na to protect young pipo from harmful content. But di pipo wey dey against am argue say e fit isolate vulnurable teenagers or push small piin go parts of di internet wey no dey regulated.
As for Australian teens, di reactions following dis informate dey mixed, some of dem say dem dey feel "insulted" while odas say dem go "get ova am quickly".
BBC Australian tori pesin, Katy Watson tok say dis na bold move wey many kontris dey watch carefully but e neva clear how di kontri goment go fit judge weda di law don work.
Di Australian goment don call dis new law say e be "world-leading". But both teenagers and tech companies don call out di law.
Howeva Austrailia communications minister, Anika Wells tok say e no dey worry am - di push back wey technology companies get ova di ban.
She tell BBC, "pesin wey get plenti small pikin go sabi how to negotiate against powers wey be lie say dem pass you". Dis na as she add say na tori of parents dem wey social media don make dia pikin suffer na im dey keep am going.
As at di time wey di Australian parliament sign di bill to law just ova a year ago, di kontri PM Anthony Albanese say "we want make our pikin get dia childhood and for parents, make dem know say we dey dia bacs gidigba".
E tell di pikin wey dey face dis social media ban say makde dem use di holiday periond take do oda tins for video wey e release bifor di ban.
E tell dem say, make dem "start new sport, learn new instrument or read dat book wey don dey siddon for your shelf for long".
E also say, "importantly spend beta time wit your friends and family dme, face to face."
E continue say na young pipo sabi pass di pressue wey dey come wen pesin engage for social media as e add say di ban na to support dem.
Earlier dis year, goment do study wey find say 96% of Australian pikin between di age of 10 to 15 dey use social media and seven of evri 10 of dem don take dia eye see harmful content like misogynistic and violent material and even content wey dey promote eating disorder and suicide.
Emma Mason wey lose her 15 year old daughter, Tilly to suicide afta dem bin dey bully am online, na supporter of di law, she tell BBC say di move na "protection" instead of "control".
She tok say, "we gatz get rules, even if dem break am".
Howeva Kath Angus wey give her 13 year old pikin Sadie, instagram account for her birthday, tok say social media dey important for pikin dem to build community.
She say her pikin don alreadi dey get "beta" role models as she tok say na "mostly for di queer community wey I think dey very important for young adolescents now."
Which social media dey banned for under 16
DI platforms wey go face loose dia under 16 users na Facebook, Instagram, Snapchat, Threads, TikTok, X, YouTube, Reddit and streaming platforms Kick and Twitch.
But sites lie YouTube Kids and Google Classroom and messaging apps like WhatsApp go still dey for small pikin dem to use.
Di Australian goment say dem go dey review di list of affected platforms.
Dem say e go dey di hand of social media companies to enforce di ban and dem go issue fines to thoese wey no take "reasonable steps" to make sure say pikin dem no fit access di sites.
Di law also advise make dem use plenti age assurances technologies live IDs, face or voice recognition.
Meta wey get, Instagram, Facebook and Threads, bin start to comot under 16 Australian pikin dem since last week from dia platforms.
Meanwhile Snapchat say users fit use bank accounts, or photo ID or selfies take do verification.
Howeva possibilities still dey say pipo go use tins like VPNs, fake accounts or dem fit even use joint accounts wit family members.
Snapchat has said users can use bank accounts, photo ID or selfies for verification.
Just how difficult it proves to enforce remains to be seen - with possibilities including fake profiles, joint accounts with family members and the use of VPNs.











