Di daughter of South Africa former President, Brumelda Zuma don dey sworn in to di parliament for her father party.
Dis dey come less dan two weeks afta her half-sister, Duduzile Zuma-Sambudla dey forced to step down from di position.
Jacob Zuma na di leader of South Africa political party uMkhonto weSizwe (MK) and her daughters dey for di parliament under same party.
Brumelda Zuma become one of South Africa newest parliament wey dem swear-in for Wednesday as she dey represent MK party.
Her half-sister, Duduzile Zuma-Sambudla wey resign from di parliament earlier na sake of allegations say she bin trick 17 men to go fight for Russia as mercenaries for Ukraine.
Although, Zuma-Sambudla don deny di accusations.
Di appointment of Brumelda Zuma be like say her father, di former president wan ensure say im family dey represented for di parliament.
Dem swear-in Brumelda wit three oda MK members, wey di party say she go "bring wealth of experience and dedication" to parliament.
Brumelda say she go focus mostly to ensure say South Africans get "good public services" becos dat wetin she study.
MK say Brumelda Zuma get degree for public administration.
According to MK party, "Brumelda Zuma dey inducted as Member of Parliament for di MK and she dey here to serve di pipo people of South Africa."
How Brumelda Zuma become member of parliament
Di terrorism trial of Duduzile Zuma-Sambudla wey be di daughter of former South Africa President Jacob Zuma bin start for di High Court for Durban on Monday, 9 November, even though she plead not guilty.
MK previously say na Zuma-Sambudla decision to resign as she wan focus her efforts to enure di return of dose wey dey trapped for Ukraine.
Dem implicate her for di Russia recruitment scheme afta South Africa govment reveal say e don receive distress calls from more dan dozen citizens wey don join di mercenary forces.
Di men dey between age 20 and 39 and dem dey trapped for Donbas.
One of Zuma-Sambudla most prominent accusers na anoda half-sister, Nkosazana Zuma-Mncube.
Zuma-Mncube bin file a criminal complaint against Zuma-Sambudla and two oda pipo, wey accuse dem of luring di men to Russia "under false pretences" and den hand dem to a Russian mercenary group "witout dia knowledge or consent".
Na di accusation bin make Zuma-Sambudla to resign from her position for South Africa parliament.
As her position dey vacant, na so dem appoint Brumelda Zuma to replace her for MK party.
Na Jacob Zuma bin form MK for 2023 afta e fall out wit current President Cyril Ramaphosa.
Di party come third for South Africa general election last year, and become di main opposition party for parliament afta di second-biggest party join coalition govment by Ramaphosa.
Who be Brumelda Zuma
Brumelda Zuma na Jacob Zuma daughter, and she bin graduate from University of Zululand wit specialization for Public Administration.
Although Brumelda Zuma neva previously get national profile, unlike her half-sister wey bin represent South Africa for di Parliament, she don enta di parliament now.
Her work dey mostly focus for KwaZulu-Natal, wey be wia her family really get strong power.
Brumelda bin participate for students politics wen she bin dey for university and she bin dey active,
Report say she bin serve as leader for di South African Students Congress (SASCO).
Also, she bin serve for regional level for di South Africa African National Congress Youth League (ANCYL) until recently.











