BBC Pidgin of Monday, 15 December 2025

Source: BBC

Wetin we know so far about di shooting for Brown University wey kill students

Police don release limited information about di suspect beyond say e be male wey wear all black Police don release limited information about di suspect beyond say e be male wey wear all black

Two students don die and nine oda pipo injure after di Brown University shooting for Rhode Island.

Some of di injured dey in critical condition and Providence Mayor Brett Smiley warn say di number of casualties fit rise.

Reports say dem call police around 16:05 local time to di campus engineering building.

End of years exams bin dey take place wen di shooting happen.

Police don release limited information about di suspect beyond say e be male wey wear all black.

Police confirm say di suspect use gun but dem no say which type.

Authorities don tell Brown University students and surrounding neighbourhoods to take shelter.

Police bin briefly detain one suspect wey dem later release after dem determine say dem no get "any involvement" for di shooting.

Authorities still dey search for di suspect.

Brown University say dem dey work to establish "support for our community and families" after di shooting.

Dem say dem don relocate di students to a secure location, where dem go get access to support services.

"Our first priority na di safety of our community," di university add.

President Donald Trump say dem don brief am about di shooting.

Speaking to reporters as e return to White House, e describe di shooting as "a terrible tin", and add say: "All we fit do right now na to pray for di victims and for those were dey very badly hurt."

"We go inform you later as to wetin dey happen" e add.

Brown university remain on lock-down.

'We hide under desks for two hours'

One student wey bin dey work for one lab inside Brown University don tok about di moment e receive di text wey alert am to a shooting nearby.

"Three oda students bin dey wit me," Cheung tell local news outlet WJAR. "We decide to turn di light off and hide under our desks."

"I bin dey hope sya nobody dey hurt, I feel like say I dey safe inside di lab," e add.

Di student say e bin dey "under di desks for two hours or so", before armed police arrive to escort dem outside.

Meanwhile, di latets shooting for Providence take di total number of mass shootings for US to 389 for di year 2025.

Dis dey based on figures from di independent analysis website Gun Violence Archive (GVA), wia dem define mass shootings as having four or more victims wey dem kill or injured, not including di attacker.

Di two students for Brown University become di 345th and 346th pipo to lose dia lives inside mass shootings for US dis year, according to GVA.

Dia data show say a further 1,800 don dey injured for di same period.

Wetin to know about Brown University

Brown University na one of di oldest and most prestigious universities for di US.

Na part of di Ivy League, wey be a group of elite universities for di north-east of di country.

Na 11,000 students dey face serious competition to dey accepted to Brown, wey dey located for Providence, di capital city of Rhode Island.

E dey around 50 miles (80km) from Boston and 180 miles from New York City.

Students bin dey on campus dis weekend for final exams, wey mark di end of di autumn semester.

Officials say di shooting hapun for di Barus & Holley engineering building, wey dey located on di eastern side of di downtown campus.

Di seven-storey building na home to di School of Engineering and di physics department, and get more dan 100 laboratories, dozens of classrooms and three lecture halls.