BBC Pidgin of Monday, 15 December 2025

Source: BBC

Wetin Supreme Court tok about di State of emergency wey Tinubu declare for Rivers State

President Bola Tinubu President Bola Tinubu

Di Supreme Court of Nigeria don give judgement say di President get power to suspend elected officials in case of State of Emergency.

Na seven man panel of Supreme Court judges deliver di judgement (6-1) dis Monday morning, on top di mata wey di Adamawa State Govment bin file togeda wit 10 oda States wey dia guvnors be members of di Peoplese Democratic Party (PDP).

Dis mata na sake of how President Bola Tinubu bin declare State of Emergency for Rivers State for March dis year, and e also suspend both guvnor Simnalayi Fubara and all di members of di Rivers State Assembly for six months.

Dat time, many pipo bin dey argue say e no dey constitution say Presido get power to suspend govnor wey pipo elect di same way dem elect di presido.

For di lead judgement of di Supreme Court wey Justice Mohammed Idris bin read out, e tok say Section 305 of di Constitution give di President power to use "extraordinary measures" to bring bak normalcy for place wia e declare state of emergency.

And since dat section no dey specific on di kain extraordinary measures wey di President fit take, e mean say di President gatz use im discretion on wetin to do.

Rememba say afta di PDP govnors bin fila dat mata for di Supreme Court, di Attorney General of di Federation (AGF) and di National Assembly also file objection, telling di court say di PDP guvnors no establish an ogbonge evidence wey dey enuf to activate di original jurisdiction of di apex court.

Normally, bifor any mata come to di Supreme Court, e suppose don pass from di High Court to di Court of Appeal.

Di only exception na wen di mata na betwin di Federal govment and di state govment, dat na di only time di mata go come straight to di Supreme Court. Na dis di court dey refer to as original jurisdiction.

As e dey deliver di lead judgement on Monday, Justice Idris agree wit di objections wey di AGF and NASS bin raise and e strike out di mata for lack of jurisdiction, but e still go ahead to determine di case on im merit and still dismiss am.

Howeva, one out of di seven-man panel of Justices give im own minority ruling in favour of di PDP guvnors, as e tok say even though di President get power to declare state of emergency, e no fit use dat power as tool to suspend elected state officials like governor, deputy governor, and members of parliament.

Brief background



Dis judgement dey come almost three months afta Presido Tinubu don end di state of emergency for Rivers State and reinstate di guvnor and also di State Assembly.

Na on March 18 for one nationwide broadcast, na im Presido declare say di crisis for Rivers State don dey enta national security mata and so e don suspend all elected officers for di State and declare emergency for six months.

Tinubu also announce retired Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (Rtd) as di pesin wey go dey in charge of Rivers State as di Sole Administrator for dat six months.

Dis na di highpoint of di plenty gbas-gbos wey bin dey go on betwin di Guvnor Sim Fubara and im bifor-bifor godfather and immediate past Rivers State guvnor Nyesom Wike.

Both strong men wey bin dey close like yam and red oil bifor di 2023 election, all of a sudden turn enemies and dia camps come divide.

Howeva, Wike still retain di loyalty of di members of di Rivers State Assembly who team up wit am and wan impeach Fubara.

Di crisis hot sotey e lead to di burning of di River State Assembly Complex, and guvnor Fubara come order make dem demolish di remaining part of di complex.

Several attempts wey top govment pipo, including President Tinubu, bin make to bring peace betwin Fubara and Wike no get head.

Na wen mata reach wia jaguda pipo start to dey bomb oil pipelines for Rivers State, na dat time Presideo say e no go take am again, and declare state of emergency.

However, since e lift di emergency situation for September, tins don dey go relatively peaceful betwin Wike and Fubara camp, even though some pipo say di peace still get k-leg.

Recently, Guvnor Fubara dump im former party PDP and join di ruling All Progressives Congress (APC) as e tok say di PDP no giv am any protection wen e bin need dem.