UK goment fit restrict visa applications for Nigerians and pipo from some oda kontris wey dem believe say dey most likely to overstay and claim asylum for di kontri.
Under one new goment plan to crackdown wey Home Office dey plan, pipo from kontris like Nigeria, Pakistan and Sri Lanka fit to find am more difficult to work and Study for UK.
Dis plan wey tori pipo Times bin be di first to report, UK ministers believe say dem get particular problem wit pipo wey go UK legally on work or study visa, only to turn begin claim asylum – which if dem go get am go allow dem stay for di kontri permanently.
One Home Office tok tok pesin say: "Our upcoming Immigration White Paper go give comprehensive plan to restore order to our broken immigration system."
Since becoming prime minister last year, Sir Keir Starmer bin promise to reduce both illegal and legal migration - but bin refuse before to give total migration target, saying "arbitrary cap" bin no get any impact in di past.
Latest figures show say 99,790 pipo bin claim asylum for UK for year ending September 2024.
In total, 9,560 Pakistani kontri pipo claim asylum last year – dis na di highest number for any kontri and almost double di number from di year before.
Part of Labour plans to reduce migration include to make am criminal offence for for anyone wey put oda pipo lives for danger for sea, to target small boat crossings, and cut demand for overseas hires by developing training plans for sectors wey dey currently rely on migrant workers.
Sir Keir don criticise di former Conservative goment say dem fail to deliver lower number of migrants "purposely, not accident".
Net migration – di number of pipo wey dey come UK minus di numbe wey dey leave – hit 906,000 in a year to June 2023, and den come fall to 728,000 in a year to June 2024.
New rules wey former Prime Minister Rishi Sunak bin introduce to reduce migration levels appear be like e follow contribute to di fall.
Di former Conservative government increase di minimum salary for skilled overseas workers wey wan come UK from £26,200 to £38,700, come ban care workers from bringing family dependants to UK.
E never clear which kontris dey most likely to overstay dia visas as Home Office never publish statistics on exit checks for pipo wey dey live for di kontri on visas since 2020, sake of one review into di accuracy of di figures.
Di numbers of many of di pipo wey dey live UK fit go unrecorded, meaning say, di fact say pipo no get departure record no necessarily mean say dem still dey inside di kontri.
Prof Jonathan Portes na senior fellow academic think tank UK for one Changing Europe, im say visa restrictions no go too get serious impact on di number of pipo wey dey find asylum.
"I tink dem no design di impact here to be primarily about numbers overall, dem design am to be about reducing asylum claims wey dem see like say pipo dey abuse am," im tell BBC Radio 4 Today programme.
"Wen you get pesin wey come here allegedly as student and den switch quickly to di asylum route... dat na abuse of di system – di goment dey try reduce am."
Labour bin already dey under pressure to make changes to di immigration system - but e be like dat pressure don grow afta Reform UK bin make success for last week local elections.
Reform win 677 of around 1,600 seats wey dem bin contest for di elections wey bin occur on Thursday for councils for wey bin mainly dey under di control of Tory, since dem last contest am for 2021.
For im general election manifesto, Reform say dem go implement freeze on non-essential immigration.
Pipo wey get some kain skill, for example for healthcare, go still dey allowed to enta UK.
Reacting to di results last week, imsef follow share di "sharp edge of fury [provoke]" wey di voters feel as dem dey move away from di major parties, come argue say e don ginja am to "go further and faster" in delivering Labour promise to change immigration and public services.
Plans to tackle overstaying bin don already dey ground even before di local elections.
Full details of goment plans dey due for publication for one new immigration white paper later for May.
One Home Office tok tok pesin say: "To tackle abuse by pipo from foreign kontris wey arrive on work and study visas and go on to claim asylum, we dey build intelligence on di profile of dis pipo to identify dem earlier and faster.
"We keep di visa system under constant review and wia we detect trends, wey fit undermine our immigration rules, we no go hesitate to take action.
"Under our plan for change, our upcoming Immigration White Paper go set out one comprehensive plan to restore order to our broken immigration system."
Latest available figures, wey cover 2023/24, say dem get reach 732,285 international students for UK.
Di number of students from Nigeria and Pakistan bin dey relatively low at 34,525 and 45,720 respectively.
Overall, UK don experience about 16% drop in international students wey dey go dia study for dis academic year afta dem begin enforce visa restrictions on dependents for 2024.











