Singer Rihanna don confam say she dey expect her third pikin while attending di biggest fashion night of di year, di Met Gala for New York.
Di 37-year-old show her bump and smile for di cameras wen she appear for red carpet, wit navy and daffodils.
Robyn Fenty, wey pipo sabi as Rihanna and her partner, rapper A$AP Rocky, don already get two sons.
A$AP Rocky, wey pipo sabi as Rakim Mayers thank tori pipo wey congratulates am on di red carpet.
"Na di time to just show di pipo wetin we bin dey cook up," e tok.
Rihanna na di last pesin to arrive at di benefit event for New York Metropolitan Museum of Art, wey mark di opening of dia Costume Institute annual fashion exhibit.
Each year celebrities dey wear big-big clothes in line wit di event theme. Dis year concept na "Superfine: Tailoring Black Style," di first since 2003 to focus exclusively on menswear.
A$AP Rocky, co-chair of di event, confam di couple pregnancy news on di red carpet.
"Thank you, thank you, thank you," di rapper tok.
"I dey glad evribody dey happy for us becos we dey definitely happy", e add.
Di couple born dia first son RZA in May 2022 and dia second son, Riot in August 2023.
Di pop star and businesswoman dey popular for her high-profile pregnancy announcements.
She debut di pregnancy of her first child wit photoshoot wit her partner for Harlem, New York City in 2022.
Wen she perform for di Super Bowl halftime show in 2023 she reveal say she dey expect dia second pikin.
She no be di first star to reveal dia baby bump at di Met Gala - di former tennis player, Serena Williams and model Karlie Kloss both don publicly reveal dia pregnancies at di 2023 event.











