BBC Pidgin of Tuesday, 29 April 2025

Source: BBC

Trump first 100 days and di fast remaking of a nation

US President Donald Trump US President Donald Trump

During last year presidential campaign, Donald Trump bin constantly repeat im intention to bring about dramatic change as soon as e go back di White House.

But few bin expect di changes to come at such breakneck speed.

In di three months since e take oath of office, di 47th president don use im power for way wey few predecessors don use am.

For stacks of bound documents wey dey signed off wit presidential pen and policy announcements wey dey in all caps on social media, im plenty executive actions don reach evri corner of American life.

To im supporters, di shock-and-awe approach na ogbonge demonstration of an all-action president, wey dey deliver on im promises and dey enact long-awaited reforms.

But im critics fear say e dey cause irreparable harm to di kontri and dey overstep im powers – wey dey cripple important goment functions and perhaps dey permanently reshape di presidency for di process.

Here na six turning points from di first 100 days.

A social media post sets off a constitutional firestorm

For once, no be Trump social media post bin spark tok-tok for di kontri.

Three weeks into di new term, at 10.13am for one Sunday morning, Vice-President JD Vance bin write nine words wey signal strategy wey don since shape di Trump administration second term.

"Judges no dey allowed to control di executive legitimate power," e declare on X.

Di post bin gada plenty reactions for media, as legal experts line up to challenge dat statement, dem point to one 220-year-old principle wey lie for di heart of American democracy.

Courts get di power to check and strike down any goment action - laws, regulations and executive orders – dem tink say violate di US Constitution.

Oga Vance words bin come across as one bold challenge to judicial authority and, more broadly, di system of three co-equal branches of goment wey America founders initiate.

But Trump and im team no dey sorry say dem extend di reach of di executive branch into di two oda domains - Congress and di courts.

Di White House bin move forcefully to grab control of spending from Congress, as dem stop di funding of programmes and entire agencies.

Di Capitol Hill, wia Trump Republicans hold slim majorities for both chambers no too put mouth on how di executive dey use power.

Di courts no gree, as ova 100 rulings don dey so far wey stop di presidential actions dem reason say dey unconstitutional, according to one tally by di New York Times.

Some of di biggest clashes wey dey ground na on top Trump immigration crackdown. For March, dem deport more dan 200 Venezuelans dem reason say be danger to di US go El Salvador. Di mata no go through di usual process wey dem go present evidence for court.

One Republican-appointed judge for federal appeal court bin tok say im dey "shocked" wit how di White House bin act.

Trump and White House officials don tok say dem go obey court rulings, even as di president blast many of di judges wey issue dem and di administration at times dey move slowly to fully comply.

Evri tin amount to one unique test of one constitutional system wey for centuries don operate under a certain amount of good faith.

While Trump dey for di centre of dis push, one of im principal agents of chaos na one man wey dem no born for US, but wey build im business empire for dia.

E wave chainsaw, dressed in black

Elon Musk, wey wear black dress from head to toe and wear sunglasses, bin stand for centre stage and dey enjoy di hailing from di Conservative Political Action Conference crowd.

Di richest man for di world, wey wan cut trillions of dollars from the federal government, bin tok say im get special surprise.

Argentinian President Javier Milei, wey dey known for im own budget-slashing, bin come up from di backstage and give am one shiny gold chainsaw.

"Dis na di chainsaw for bureaucracy," Musk bin shout. "CHAINSAW!!"

Dis na dramatic illustration no be only of Musk enthusiasm for di "Department of Government Efficiency" (Doge) assignment wey Trump give am, but also of di near rock-star status wey di South African-born technologist don develop among Trump supporters.

Since dat appearance, Musk don send im operatives across di federal government, wey dey push to access sensitive goment databases and identify programmes dem go slash.

Although e neva come anywhere near to finding di trillions of dollars of waste wey e promise, im cuts don seriously reduce dozens of agencies and departments - essentially e shut down di US Agency for International Development (USAID) and e attempt to scata di Department of Education.

While pledges to cut "waste, fraud and abuse" for goment and trim di large federal deficit typically get broad appeal, di manner wey Musk take dey use im metaphorical chainsaw don lead to conflict wit senior goment officials and ginger anger among some of di American public.

Some Trump supporters fit approve di administration aggressive budget-cutting but oda constituents don kick against di Republican legislators for town hall events.

Hecklers bin express fear say di cuts go negatively affect popular government programmes like Social Security retirement plans, veterans benefits, and health insurance coverage for di poor and elderly.

Dia concerns fit dey valid, sake of say these schemes make up di bulk of federal spending.

If dem no cut back these programmes, di sweeping tax cuts wey Trump promise for further increase di scale of US government debt and put at risk arguably im biggest election promise - economic prosperity.

'I gatz think fast as billions dey miss bifor my eyes'

Wen trader Richard McDonald see as Trump hold up im charts for di White House Rose Garden wey show list of kontris wey di US tariffs bin target, e know say im gatz act fast.

"I bin jump to my feet becos I bin no dey expect a board [of charts] - I bin dey expect announcement," e tok.

McDonald bin dey expect tariff cuts of 10% or 20% but say "nobody bin expect these huge numbers".

E bin try to understand which companies go dey affected di most.

E be one of di many traders wey bin dey di coal face of global markets wen share prices drop everywhere afta Trump so-called "Liberation Day" tariff announcement.

Di S&P 500 index of di largest firms bin dey hardly hit - and even though di White House don reverse course on some of di highest tariffs, dem neva still fully recover since den.

Di economy na di biggest concern for US voters for November election, and Trump bin ride on a tide of deep unhappiness on top how Biden take handle inflation all di way to victory.

Im pledge to cut prices, cut back government regulation and boost homegrown industry na one pro-business message wey many on Wall Street and many working Americans receive warmly.

But as Trump try to follow through on im promise of new tariffs, di economic costs, at least for di short term, don become painfully clear.

Di stock market dey sink, interest rates – wey include for home mortgages – dey rise, and consumer confidence dey low. Unemployment also dey rise, in part sake of di growing number of federal employees wey dey forced out of dia jobs.

Di Federal Reserve Bank, along wit economic experts, don warn say Trump plan go shrink economic growth and e go possibly lead to a recession.

While di president approval ratings on di way e take dey handle di economy don tumble, many of im supporters still dey support am.

"Trump don earn back di respect," one truck driver Ben Maurer tok for Pennsylvania, referring to tariffs on China. "We still be di force to be reckoned wit."

Economic concerns don contribute to Trump overall decline for di polls, but for one key area, e still dey solid for public eye - immigration.

Spotted in a photo - 'My son, shackled in prison'

"Na im! Na im! I recognise im features," Myrelis Casique Lopez tok as point to di foto of one man wey dem tie and handcuff for di floor of one of di dangerous prisons for di world.

She bin see her son for one of di foto dem take of men wey dem shave dia heads, wey wear white T-shirts and siddon for one long, straight rows.

Di last time she bin get contact wit her son, na wen e dey for di US and dey face deportation to Venezuela but now e dey 1,430 miles (2,300 km) away from her, e be one of di 238 men wey di US authorities send to one notorious mega-jail for El Salvador.

Di Trump administration tok say dem be members of di Tren de Aragua gang - one powerful, multi-national crime operation - but Ms Casique insist say her son dey innocent.

A tough stance on immigration na di central focus of Trump re-election campaign, and di president don use im broad powers of enforcement to deliver dat pledge.

Illegal border crossings bin dey fall for di end of Biden presidency, but now dem dey dia lowest monthly total for more dan four years.

Majority of di US public still support di crackdown, but e bin get chilling effect on communities of foreign students wey don find themselves for di middle of di gbasgbos.

Some, wey include permanent residents, don chop detention and dey face deportation sake of dia role for one pro-Palestinian campus protests. Dem don reject di accuse say dem support Hamas.

Civil rights lawyers warn say dem dey deport some migrants without due process, dem add say dem dey sweep innocent pipo among di "killers and thugs" wey Trump tok say be di target.

Clash wit academic, media and corporate worlds

On 21 April, Harvard University president, Alan Garber, bin decide to follow di White House bumper to bumper.

For inside one letter to di university community, e bin announce one lawsuit wey challenge Trump administration move to freeze billions of dollars in federal grants.

E tok say na illegal attempt to "impose unprecedented and improper control" ova Harvard operations.

Di White House say dem gatz take action becos Harvard neva tackle antisemitism on campus - one issue wey Garber say di university dey take steps to address.

But di Ivy League college move na di most prominent display of resistance against Trump use of presidential power to target American higher education, one longstanding goal wey ginger pro-Palestinian protests wey engulf campuses for 2024.

Di president and im officials don since impound or threaten to withhold billions of dollars in federal spending to reshape elite institutions like Harvard, wey di president and many of im supporters think push liberal ideology on students and researchers.

Earlier in di month, Columbia University for New York City bin agreed to some of White House demands, wey include changes to dia protest policies, campus security practices and Middle Eastern studies department.

One similar dynamic bin play out for di corporate and media worlds.

Trump bin use di withholding of federal contracts as way to pressure law firms to recruit and represent more conservatives.

Some of di firms' don respond by offering di Trump administration millions of dollars in free legal services, while two firms don file suit wey challenge di constitutionality of di administration punishments.

One defamation lawsuit wey ABC News bring against Trump bin make di media company contribute $15m (£11m) to Trump presidential foundation.

CBS also dey try separate one lawsuit ova one Kamala Harris interview, as dia parent company Paramount dey seek federal approval for one merger wit Skydance Media.

Di Associated Press, by contrast, don resist di administration pressure to accept Trump "Gulf of America" name change despite di White House efforts to block di news agency from coverage of di president.

On di campaign trail, Trump bin warn about di runaway power of the federal government. Now for office, e dey use dat power for way no previous modern president don attempt to use am.

Di areas wey di impacts of im policy dey felt di most na within di federal government agencies and departments wey e dey control now.

A retreat on race and identity

Di press conference for White House start wit silence for di victims of aircraft collision over di Potomac River.

Within seconds of di pause wey just dey end, however, Trump just dey on di attack.

A diversity and inclusion initiative for di Federal Aviation Agency dey partly to blame for di tragedy, di president claim, becos dem hire pipo wey no get sense as air traffic controllers. E no provide any evidence.

Na startling moment wey show di kain attack wey im presidency don launch against inclusivity programmes wey don too much in recent years across di US government and corporate world.

Trump bin direct di federal government to end dia diversity and equity (DEI) programmes and investigate private companies and academic institutions dem tink say dey engaged in "illegal DEI".

Im directive don accelerate moves among leading global companies like Meta and Goldman to cut back or eliminate these programmes.

First introduced in di 1960s for di wake of civil rights victories, early forms of DEI na attempt to expand opportunities for black Americans. Dem later expand am take in women, LGBT rights plus oda racial groups.

But to dia critics, DEI na putting politics and race above talent, wey create division and no longer dey needed in modern America.

While e be like say Trump get di support from a narrow majority of voters, some of di unexpected consequences don raise eyebrows.

Arlington National Cemetery remove from dia website all mentions of di history of black and female service members. And di Enola Gay aircraft wey bin drop atomic bomb on Japan bin dey initially flagged for removal from Pentagon documents, sake of di word "gay".

Donald Trump first 100 days don see unprecedented display of unilateral power exercised by a modern American president.

Im efforts to dismantle large swaths of di federal government go take years, if not decades, for subsequent presidents to restore - if dem so desire.

In oda ways, however, Trump efforts so far fit no dey permanent. Without di support of new laws passed by Congress, one future president fit wipe away many of im sweeping reforms.

And so to what extent this whirlwind start leads to lasting change remains an open question.

Later dis year, di narrow Republican majorities in Congress go attempt to provide di legislative backing for Trump agenda, but dia success dey far from guaranteed.

And for next year mid-term congressional elections, those majorities fit dey replaced by hostile Democrats wey dey bent on investigating di administration and limiting im authority.

Meanwhile, more court battles loom - and while di US Supreme Court get conservative tilt, dia decisions on several key cases fit ultimately cut against Trump efforts.

Di first 100 days of Trump second term be dramatic show of political force, but di next 1,361 go be di real test of weda e fit carve an enduring legacy.



America founders bin craft di three co-equal branches of government - legislative, executive, and judicial