BBC Pidgin of Wednesday, 30 April 2025

Source: BBC

Mystery for South Africa as dem find police officers deadibody inside river

Dem bin last see Keamogetswe Buys (L) and Cebekhulu Linda (R) one week ago inside white VW PoLO Dem bin last see Keamogetswe Buys (L) and Cebekhulu Linda (R) one week ago inside white VW PoLO

Police for South Africa dey find ansa afta dem see di deadibody of three police officers - wey bin dey miss for six days - inside river.

Boipelo Senoge, dey 20 years, Cebekhulu Linda dey 24 years, and 30-year-old Keamogetswe Buys.

Dem bin last see dem wen dem bin dey comot from petrol station near Johannesburg last Wednesday.

Na divers see dia deadibody around 70km (43 miles) away for Hennops river, along wit di lifeless body of two oda pipo wey den no name.

Di police bin initially tok say dem dey investigate a case of "possible hijacking and kidnapping" but on Tuesday dem tok say dem no fit guess weda di officers die by accident or not.

All di three police officers na constables - dem bin dey travel wit one white VW Polo wen dem miss, na wetin police statement tok.

Dia vehicle tracking device and mobile phones dey off since dat time.

One search team bin "spend sleepless nights as dem bin dey comb di length and breadth" of di Gauteng, Free State and Limpopo provinces back to back.

Dem bin eventually find parts of one vehicle wey dem "beliv say na" di VW Polo, national police commissioner Fannie Masemola tok

Dem bin find one Renault Kangoo van nearby on di banks of Hennops river, for di municipality of Centurion.

Di three officers bin dey travel from Free State to Limpopo, wen dem bin miss.

Divers bin search dat part of di river and recover five deadbody between Monday and Tuesday.

Along wit di three constables, di divers find di deadbody of a police admin clerk, wey dem neva name.

Di clerk bin dey drive di Renault van, Gen Masemola tok.

Im add say di fifth body bin don dey rotten and dem neva fit identify am.

Police for South Africa still dey find di VW Polo wey di officers wey dem see dia deadibody bin dey travel wit.

South Africans bin dey follow di search for di missing police officers. Di public bin dey chook eye well-well wit prayer for di three constables wey bin spread across social media.

Afta dem see dia deadibody, dia loved ones wey dey heartbroken gada along di bank of di Hennops river, wit candles for dia hands.

For im address on Tuesday, Gen Masemola tok say: "We no want to guess wetin lead us to find dia lifeless body for dis river at dis stage, weda na accident or not, our investigation go reveal di aspects once we find dia vehicle."

Dis mark a significant change in tone from Sunday, wen di commissioner bin tok say: "We no go fit get criminals to lookdown on di authority of di state by kidnapping three police officers.

Dis na just a serious warning to di pipo behind dis incident, either you hand yoursefs ova, or we go catch you by oursefs."