BBC Pidgin of Friday, 24 January 2025
Source: BBC
Police for Rivers state parade two alleged fake pastors wey youths for Rumunduru communuty arrest for Obio/Akpor Local Goment Area of di Southern state.
Police tok tok pesin for di State SP Grace Iringe Koko tell tori pipo say na di youth president of Rumunduru community Henry worlu, wey arrest di suspects on 20 January 2025 and hand dem over.
Dis follow tori wey bin dey trend for social media about di arrest of fake pastors wey youths catch for Rumunduru say dem allegedly bury coffin for di church and dem find python snake inside di church.
Iringe-Koko say di suspects come from Akwa Ibom State and dem find one catridge, one sword, fake naval passport, thousands of pipo pictures, one leg of small pikin shoe, different cross and spiritual materials inside di church but dem no recover any live python and human skull.
One of di suspects wey be di pastor of Church of God Apostolic Deliverance church in Eneka, Rumunduru say im dey do prayer wit spiritual materials di way God direct am and notin else, come add say di accuse against am na just set up.
"I don dey heal pipo, dey help di community. I don live dia for 17 years. Some of di pictures you see dia na dat of my son and some na dat of my members." E explain.
"Na land case be di issue. I still get three weeks afta di court judgement wey ask me to quit bifor all dis tins dey happun. Dem use am to step me up. Na di community plant some of di materials wey dem claim say dem see inside my church. Dem search my house without warrant." E tok.
E also explain say e dey, "use di small casket or miracle life oil to pray for mad pesin and di mad person must be calm within three months. I dey use am to help di community pipo," na so e claim.
Di oda suspect, wey be di pastor of Power of God House Ministry explain say im bin dey for di church becos im bin get meeting wit di pastor wen OSPAC and di community come arrest dem.
Henry Worlu, di Youth President of Rumunduru tell tori pipo say na di OSPAC commander for di community na im allege say di Pastor bin dey do sacrifice for road.
"In di morning, we go im Church and e deny. Im no allow us enta until we enta inside im chamber and see all these items
"Nobodi assault am, we just hand dem over to di Police." E tok.
Police tok tok pesin add say dem don begin investigate di matter while di suspects remain for custody.

Di community youths claim say dem see python and coffin insdie di pastor chambers but police confam say those tins no dey among di items dem recover

Some of di items dem recover from di church after Youths from Rumunduru arrest di pastors