BBC Pidgin of Thursday, 18 December 2025

Source: BBC

Nigeria apologise to Burkina Faso but wen di 11 detained soldiers go return?

Photo of di 11 millatry personnel and Nigerian delegate Photo of di 11 millatry personnel and Nigerian delegate

Di 11 Nigerian military personnel wey Burkina Faso authorities detain afta one Nigeria Air Force aircraft make one emergency landing for di West African for early December go soon return to Nigeria.

Special Assistant on Media to di Nigeria Minister of Foreign Affairs Alkasim Abdulkadir confam dis informate give BBC, afta one high level delegation wey di minister Yusuf Tuggar lead meet wit Burkina Faso authorities on Wednesday, 17 December for di West African kontri.

Abdulkadir say "Dem go return to Nigeria but dem neva come yet".

E neva dey clear exactly wen di military personnel and di plane go come back di kontri.

Oga Tuggar wey deliver message of "solidarity and fraternity" from Nigerian President Bola Tinubu to di Burkina Faso junta leader Capt Ibrahim Traore tok on TV broadcast say "irregularities bin dey di documents, particularly concerning di overflight authorizations for Burkina Faso. Dis dey regrettable and we apologise for dis unfortunate incident."

"We also discuss di mata of a Nigerian party leader making disgraceful comments on top dis incident. Dis undoubtedly link to a misunderstanding of the situation," e add.

Na on 8 December, one Nigerian Air Force C-130 make emergency landing for Burkina Faso as dem dey go Portugal, afta di aircraft technical fault, Nigeria govment tok.

Di incident bin cause diplomatic tension between Nigeria and di Alliance of Sahel States (AES), wey include Burkina Faso, Mali and Niger.

Di AES bin earlier describe di landing as a "violation of dia airspace and sovereignty."

Afta di meeting, di Nigeria Foreign Affairs minister say di two countries don "amicably resolve di issue wey concern di Nigerian Air Force pilots and crew, and don strengthen mutual confidence plus di effectiveness of dialogue."

E add say both sides don "agree to sustain regular consultations and pursue practical measures to deepen bilateral cooperation and regional integration".




Nigeria delegate wey Nigeria Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar lead wit Burkina Faso junta leader Capt. Ibrahim Traore