BBC Pidgin of Thursday, 18 December 2025

Source: BBC

NMDPRA MD Ahmed Farouk resign after allegation from Dangote, Tinubu nominate replacement

Foto mix of Ahmad Farouk and Aliko Dangote Foto mix of Ahmad Farouk and Aliko Dangote

Nigeria President Bola Tinubu don nominate two new chief executives for di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) and di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC).

Dis dey come afta Engineer Farouk Ahmed, Managing Director of NMDPRA and Gbenga Komolafe, wey be Chief Executive of di NUPRC resign from dia position.

Oga Farouk resignation dey come after allegation from businessman, Aliko Dangote against am of "economic sabotage".

Allegation wey e bin deny.

According to statement wey Special Adviser to di Nigerian president on Information and Strategy, Bayo Onanuga sign, "di request follow di resignation of Engineer Farouk Ahmed of di NMDPRA and Gbenga Komolafe of di NUPRC. Both officials bin dey appointed for 2021 by former President Buhari to lead di two regulatory agencies created by di Petroleum Industry Act (PIA)."

President Tinubu don already write to di Senate make dem confam Oritsemeyiwa Amanorisewo Eyesan as di Chief Executive Officer of di NUPRC and Engineer Saidu Aliyu Mohammed as Chief Executive Officer of NMDPRA.

Profile of di new CEOs

According to di statement from Onanuga, di two nominees na seasoned professionals for di oil and gas industry.

Oritsemeyiwa Amanorisewo Eyesan> na graduate of Economics from di University of Benin, and im don spend nearly 33 years wit di NNPC and oda companies under di NNPC.

She bin retire as Executive Vice President, Upstream between 2023–2024, and she bin don serve as Group General Manager, Corporate Planning and Strategy for NNPC from 2019 to 2023.

Engineer Saidu Aliyu Mohammed, na graduate from Ahmadu Bello University. Im graduate for 1981 wit Bachelors degree for Chemical Engineering and na for 1957 dem born am for Gombe State.

On Wednesday 17 December na im dem announce am as independent non-executive director for Seplat Energy.

Im work include, Managing Director of Kaduna Refining and Petrochemical Company and Nigerian Gas Company, plus di Chairman of di boards of West African Gas Pipeline Company, Nigeria LNG subsidiaries, and NNPC Retail.

Im bin don serve as Group Executive Director and Chief Operating Officer, Gas and Power Directorate, wia im bin provide strategic leadership for major gas projects and policy frameworks, wey include di Gas Masterplan, Gas Network Code, and contributions to di Petroleum Industry Act (PIA).

Engineer Mohammed bin play important role to deliver key projects like di Escravos–Lagos Pipeline Expansion, di Ajaokuta–Kaduna–Kano (AKK) Gas Pipeline, and Nigeria LNG Train.

E dey expected say di Nigeria Senate go confam dis pipo sharp-sharp as dem bin do for di Minister of Defence own.

E neva tey wey President Bola Tinubu replace di Minister of Defence wey bin resign sake of im health.

And im request to di Senate na sharp-sharp.