BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023
Source: BBC
Victims of kidnapping wey dey stay for Gandu community, home of di Federal University of Lafia, (FULAFIA) say di tin wey dia eyes don see no be small.
Dis na afta tori break on Thursday morning about how jaguda pipo go kidnap some students of di university wey dey stay for Gandu community on Wednesday night, 6 December, 2023.
One of di victims, Daniel Ebuga, wey be third-year student narrate to BBC Pidgin di trauma wey im pass thru months ago wen dem kidnap am.
Im say "na evriday dem dey kidnap pipo witout any fear" di students and pipo wey dey stay for di community don dey endure painful ordeal as jaguda pipo still dey continue to kidnap dem.
"Di police no dey help us, di criminals dey come raid evritime especially on Mondays. Dem don make life for campus dey full of constant fear. How we wan take write exams wit dis fear?" E tok
Another student say di recent incident wey happun wia dem kidnap a group of students wey dey stay inside one lodge named Confidence be victims, and na only few pipo manage to escape.
Di student accuse police of extortion. Dem say police dey collect moni from dem but no dey give dem beta security.
"We want police again, we want di military to help us," she tok
Di students tell BBC Pidgin say dem no dey fit sleep peacefully again. Dem dey request for security post wey di military go man, and na di only way dem go get beta solution to dia security palava.