You are here: HomeNews2018 01 12Article 616792

General News of Friday, 12 January 2018

Source: bbc.com

Martin Amidu: 'Killer nkuto' go be special prosecutor p? 'politicians no fit sleep'

Martin Amidu, Former Attorney General Martin Amidu, Former Attorney General

Ghanaians say di nomination of 'killer nkuto' - Martin Amidu as Special Prosecutor (SP) come like rapture; menerz dey talk for social media say President Nana Akufo-Addo drop in name p? some politicians start dey walk go Nsawam Prisons!

Charlie, dem say others still dey inside room now-now! Dem no fit comot house, di last group di? dem all dey queue inside for Korle Bu hospital, dem get diarrhoea.

'Ghana go sweet pass World Cup'

Even as Ghana no qualify for di 2018 Fifa World Cup, di nomination Mr Amidu don takeover. People dey talk say Ghana go still sweet k?k? sake of he go organise SP tournament give all corrupt politicians.

Rawlings saf hail Amidu

Former President Jerry Rawlings saf dey clap for Amidu, wey country people dey also call 'citizen vigilante.'

E say: "no better choice dey pass as…Mr Amidu prove in bodi say he no dey fear anybody for in pursuit as anti-corruption corruption crusader who stand by truth den justice."



Mr Rawlings big up President Akufo-Addo sake of he no allow make partisanship block in mind; e say instead Akufo-Addo carry somebodi wey be very principled.

Generally, chaw people dey talk say play no dey Mr Amidu in eye top; dem believe say he go fit match corrupt politicians boot for boot.

Ghana di? some people dey carry di issue play la

See dis paddy den what he dey talk about some Ghanaian politicians:
Meanwhile, reports for Ghana dey show some some people no make happy over Mr Amidu in appointment kraaa!




Bh?t why others no make happy?

Despite say chaw Ghanaians make jolly sake of di nomination of Martin Amidu as SP, some National Democratic Congress (opposition) people no make happy at all. Dem bore sake of for demma mind inside Mr Amidu go target them, even though dem be from di same party.

Political scientists for Ghana say Mr Amidu in nomination be di most objective in di history of Ghana.



Dem add say Mr Amidu be member of di opposition NDC, but he no dey fear anything; he fire menerz like Former President John Mahama sake of in administration get chaw corruption scandals.