You are here: HomeAfricaBBC2024 05 13Article 1930741

BBC Pidgin of Monday, 13 May 2024

Source: BBC

Why Melinda French Gates dey resign from di Bill & Melinda Gates Foundation

Melinda French Gates, ex-wife of  billionaire Bill Gates Melinda French Gates, ex-wife of billionaire Bill Gates

Melinda French Gates don announce her decision to resign as co-chair of di Bill & Melinda Gates Foundation.

Melinda Gates as pipo sabi her don help to lead di Foundation since 2000.

As part of her separation agreement from former husband Bill Gates, French Gates say she go collect an additional $12.5 billion for her charitable work.

French Gates say she plan to focus her giving on groups wey focus on women and families.

“Dis decision no dey easy for me,” she tok for statement wey she post on X.

“I dey deeply proud of di foundation wey Bill and I build togeda and of di extraordinary work e don dey do to address injustices around di world.”

French Gates say she plan to leave di Bill & Melinda Gates Foundation on June 7, and she go share more about her future charitable plans in di near future.

Oga of Microsoft giant and di Bill and Melinda Gates Foundation, Bill Gates, for inside a separate message tok say im dey fully committed to di work wey di Foundation dey do.

For di post wey im make for X, I’m tok say “Looking ahead, I go remain committed to di work wey di Foundation dey do across all our strategies, and to realise di opportunities we get to kontinu to improve di lives of millions wey dey around di world”.

Pipo bin don dey tok say French Gates go comot from di Foundation for many years.

Na for May 2021 wey Bill Gates and French Gates divorce.

During dia divorce, dem bin tok say dem go give diasefs small time, dem describe dis time as trial period for 2023 wey go determine if dem go fit kontinu to work tigers to manage tins for dia Foundation.

For July 2021 do CEO of di Foundation Suzmann bin announce one contingency plan wey go “make sure say work for di Foundation kontinu.

“If afta two years any of dem decide say dem no go fit longing to work togeda as co- chairs, French Gates go resign her position as co-chair and trustee." Suzanne tok.

Gates go still dey in control, im go buy out French Gates for di Foundation. Na Wetin Suzmann bin tok dat time.

French Gates go receive “personal resources” from Gates for here own personal work-resources wey go “dey completely separate from wetin di Foundation get”.

Wetin di Bill and Gates Foundation dey do
Di main aim of di Bill and Gates Foundation na to make healthcare beta for developing kontris.

Give beta opportunities for education. Dem dey also reduce poverty through di support wey dem dey give pipo through grants and support to differentiate initiatives and organizations for di world.

Bill Gates former wife French Gates also get anoda charity foundation.

Di Foundation dey try to remove di barriers for minority women for di US for 2015.

Na one billion dollars she put for di organization for 2019.

Melinda French Gates Profile
Melinda French Gates na di ex-wife of software giant Microsoft owner Bill Gates.

She be American philanthropist, businesswoman and di co-founder of di Bill and Melind Gates Foundation.

Na 15 August 1964 dem born her and she dey ranked as one of di most powerful women for di world by Forbes magazine.

For 2000, she and her former husband Bill Gates collabo to open di Bill & Melinda Gates Foundation.

Dis Foundation na di biggest private charity organization in di world.

Dem bin give she and her former husband di US Presidential Medal of Freedom and di French Legion of Honour awards.

Di BBC bin recognise her as one of di BBC 100 women of 2021.

Na for May 2021, Bill and Melinda Gates announce say dem wan divorced.