You are here: HomeAfricaBBC2024 04 19Article 1926975

BBC Pidgin of Friday, 19 April 2024

Source: BBC

Gunmen attack on Plateau state university, Magun community – wetin we know

File photo File photo

Jagunda pipo don kill 13 pipo for two separate attacks for two local goment area for Plateau State on Friday.

Di bandits allegedly attack Mangu local goment area for Plateau State wia dem kill 11 pipo while dem also launch attack anoda on Plateau State University Bokkos wia dem kill two undergraduates students around 1:00am on Friday.

According to Plateau State police tok-tok pesin Alfred Alabo, di gunmen attack Magun and Bokkos community for Plateau State early mor-mor on Friday.

Di police tok-tok pesin say di gunmen attack five victims for Plateau State university for Bokkos local goment "three students dey receive treatment for hospital but two students die for di attack."

“Di attack happun for Mangu and Bokkos local goment around 1:00 am on Friday," di police tok-tok pesin tok.

While Oga Alabo tok say no be 12 pipo die for di attack for Mangu local goment, e confam to BBC Pidgin say na 11 pipo die for di attack.

"No be 12 pipo die na only 11 pipo we fit confam say dem die," e tok.

Di state police tok-tok pesin tok say dem don deploy police officer to go fish out di bandits while dem dey work with oda sister security operatives to ensure say dem catch di criminals.

Caleb Mutfwang, di govnor of Plateau State tok say di kasala wey happun for Plateau state lead to di death of one 200 level computer science student.

E tok dis one inside one press statement wey im media aide, Gyang Bere post ontop im facebook page on Friday.

Di govnor describe di attack as “barbaric” den reassure di citizens and students of goment commitment to protect dem.

Di govnor urge dem to remain calm in di face of di tragedy, as im goment dey determined to arrest and prosecute di jagunda wey dey responsible for di “heinous act.”

"Govnor Mutfwang stress di importance of collaboration among di university management, students, community leaders, and security agencies for enhance security and di safety of everyone in di area," di statement tok.

However, Plateau State University Registrar, Yakubu Ayuba, also confam di death of one 200 level student for di university, Dading James Jordan for Chikam, one neighbouring community to Plateau State University Bokkos.

E tok say despite dia effort to improve security e dey sad say di school enemies attack di school.

Di registrar send im condolence to di relative of di deceased.

Inside anoda press statement, di registrar tok say dem go close di university for 10 days and extend di date for di school exam to 2 May.

E add say buses dey on ground to carry stranded students from di school campus.

Di lawmaker wey dey represent Plateau Central senatorial district, Diket Plang also pay condolence visit to di communities members to see di situation on ground and support to di affected families.

On 26 December, 2023 gunmen attack some communities for Plateau State wia dem kill more dan 115 pipo for Bokkos and Barkin-Ladi Local Goment Areas of di state.

For 2022 mass killing bin happun for Kanam Local Goment Area.

One young lady lose her three brodas for di massacre wey kill at least 150 pipo.

For May 2023, anoda mass killing bin happun for Mangu Local Goment Area

Di attack happun for communities for di villages for Mangu LGA.