You are here: HomeAfricaBBC2024 04 10Article 1925725

BBC Pidgin of Wednesday, 10 April 2024

Source: BBC

Four-week-old baby suffer broken neck plus many oda injuries im papa give am bifor im death

Ollie Davis bin suffer 23 broken ribs in addition to a number of oda injuries Ollie Davis bin suffer 23 broken ribs in addition to a number of oda injuries

Court don sentence one man wey kill im baby son to at least 22 years in prison.

Ollie Davis, Michael Davis son bin dey unresponsive wen dem see am for im house for Beaumont Leys, Leicester, for 2017 - di four-week-old bin suffer broken neck plus dozens of oda injuries.

Court find Ollie mother, Kayleigh Driver, guilty say she cause or allow di death of di child and cause or allow di child to suffer serious physical injury.

Dem jail her for seven years.

Dem find di parents guilty for March afta one trial for Leicester Crown Court.

Wetin di court hear

Jurors hear say Ollie bin suffer 23 broken ribs, fractures to im skull, collar bone, di two arms and di joints of all im limbs bifor im death.

Di court bin hear say di baby die from di delayed effects of a broken neck.

For Loughborough Magistrates' Court – wey dey act as crown court - Oga Justice Cotter give 29-year-old Davis life sentence wit a minimum prison term of 22 years on Wednesday.

As e dey sentence Davis go jail, Justice Cotter tok say: "I no get doubt say during di night you become frustrated and angry and na wetin lead you commit dis terrible violence.

"You beat am on multiple occasions.

"Di different attacks for dia various forms also dey brutal - in particular di fatal neck injury."

Afta e tok say im dey sure say na Davis cause all di injuries during four separate overnight "episodes" of violence, Justice Cotter say dem use "at least five different mechanisms" to cause di "terrible array of injuries".

Di judge say Driver wey be 31-year-old wey di jury no find guilty of di murder, "for don hear as Ollie dey cry sake of di assault".

"Una two dey togeda for di bedroom. E for don wake you up," e tok.

Family react to di sentencing of Ollie parents

Afta dem sentence di couple, Ollie grandfather, Ricky Driver say dia arrest bin "shake di family well-well".

"Ollie dey perfect in evri way wen dem born am," e tok.

"Dem dey beat am steady and dem leave am to die wit im injuries.

"Dis na our worst nightmare. How anybodi go wan hurt a beautiful baby dey beyond words.

"We feel sick to our stomachs, and we don cry so tey and dey tink of wetin Ollie go through for im final days.

"Dis don change our family forever and we suffer mentally from dis evil actions.

"No sentence dem impose go eva reflect di heartache and pain my family dey go through."

Dem find di couple guilty afta two-month-trial, wey hear as dem find Ollie lifeless for im crib for inside di bedroom e share wit im parents for Upper Temple Walk for Leicester, on di morning of 21 October 2017.

How Ollie take die?

DI jury hear say di baby die from di delayed effects of a broken neck and post-mortem examination show say e get a total of 40 bone fractures.

Di injuries wey dey im body show say na from di beating dem beat am for different times up to 10 days before im death, di court hear.

Jurors bin hear say di fatal injury bin happun between four and eight days bifor Ollie death.

Leicestershire Police tok say medical experts see say di fractures e get be non-accidental and na serious physical abuse cause dem.

Afta di sentencing, Det Insp Mark Parish tok say: "Ollie na new-born baby wey rely on im parents for evritin e need and na dia duty to love and protect am.

"Instead, dem let am down in di most terrible way imaginable.

"Sake of di amount of injuries Ollie suffer and medical expertise wey dey needed to examine dose injuries, e take more dan six years for dis investigation to come to court and for court to hold Ollie parents accountable for im death.

"During dis extremely difficult time, Ollie wider family don deal wit so many emotions but throughout, dem remain not only co-operative to di investigation but extremely supportive and I wan thank dem for dis.

"I hope today sentencing go now allow dem to begin come to terms wit wetin bin dey truly unbearable time."



Court find Michael Davis guilty of murdering im four-week-old son