You are here: HomeAfricaBBC2024 01 12Article 1911947

BBC Pidgin of Friday, 12 January 2024

Source: BBC

Di most powerful passports for 2024 and di weakest - Report

File foto File foto

Henley & Partners don list six world most powerful passports wey dey drag di highest spot for world best passports document in 2024.

Di London-based global citizenship and residence advisory company Henley & Partner tok say di company base dia findings on Utilizing International Air Transport Association (IATA) data.

Inside di report, na four European kontris dominate for di top ranking (France, Germany, Italy and Spain) wit travel acess to 194 kontris on visa free or visa on arrival. Dis na di highest number wey Henley & Partners don record since 2005.

While two Asia kontri Signapore and Japan wey be di strongest for di past five years reflect for as di top ranking kontris wit travel access to 194 kontris visa free

Di index evaluate passports from 227 kontris based on dia strength to travel to kontris visa-free.

Passports dey grant access for citizens across di world but na rich kontris top di list while most low-income kontris of the world dey di buttom of di list.

United Arab Emirates be di kontri wit di biggest shift changes in passport mobility within 10 years.

Di kontri passport jump from 55 position to 11 position wit 106 destinations visa-free travel according to Henley & Partners.

Also, China and Ukraine gain travel access to 21 destinations visa-free entry within 10 years.

Di top ranking passports for 2024, according to di Henley Passport Index


  1. France, Germany, Italy, Japan, Singapore and Spain (194 destinations)
  2. Finland, South Korea and Sweden (193 destinations)
  3. Austria, Denmark, Ireland and Netherlands: (192 destinations)
  4. Belgium, Luxembourg, Norway, Portugal and United Kingdom: (191 destinations)
  5. Greece, Malta and Switzerland: (190 destinations)
  6. Australia, Czechia, New Zealand and Poland (189 destinations)
  7. Canada, Hungary and United States, Czech Republic (188 destinations
  8. Estonia and Lithuania (187 destinations)
  9. Latvia, Slovenia and Slovakia (186 destinations)
  10. Iceland (185 destination)

Di least ranking passports for 2024, according to di Henley Passport Index

95. Iran, Lebanon, Nigeria and Sudan (45 destinations)

96. Eritrea and Sri Lanka (43 destinations)
97. Bangladesh and North Korea (42 destinations)
98. Libya, Nepal andPalestinian (40 destinations)
99. Somalia (36 destinations)100. Yemen (35 destinations)
101. Pakistan (34 destinations)
102. Iraq (31 destinations)
103. Syria (29 destinations)

104. Afghanistan (28 destinations)

Top 10 African passport ranking for Henley Passport Index?

Di first Africa kontri wey appear for di list na Seychelles. Seychelles dey rank number 26 position for di Henley Passport Index. Citizens get access to 156 kontris around di world without visa.

Di kontri jump three spot as dem rank 29 for 2023 ranking, and e dey popular for tourist destinations.

Mauritius dey follow am for back wit ranking of 30 position. Citizens fit travel to 150 visa-free kontris.

Gambia wey be di first West Africa kontri wey appear for di list dey 72 position wit 70 visa free-entry while Nigeria dey 95 position wit 45 visa-free entry.


Dis na di 10 ogbengbe passports for Africa:

Seychelles passport rank 26 position (156 destinations)

Mauritius passport rank 30 (150 destinations)

South Africa passport rank 53 (108 destinations)

Botswana passport rank 59 (91 destinations)

Lesotho and Namibia rank 65 (80 destinations)


eSwatini rank 66 (78 destinations)

Kenya and Malawi rank 67 (76 destinations)

Tanzania rank 69 (73 destinations)