You are here: HomeAfricaBBC2024 02 26Article 1918787

BBC Pidgin of Monday, 26 February 2024

Source: BBC

Di facts as Ipob leader Nnamdi Kanu ready to face im charges Federal High court

One time Nnamdi dey for court One time Nnamdi dey for court

Di trial of di leader of di vanned Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu resume on Monday for di Federal High Court, Abuja.

Kanu dey face charges of treason wey Nigeria goment sama am afta dem rearrest am in June 2021.

Di court hearing dey come afta di Supreme Court ruling for 15 December 2023, wey tok say Kanu must to face trial.

Di apex court dismiss di earlier judgement of di Court Appeal for October 2022 wey clear Kanu of all charges against am.

Kanu lawyers fit re-apply for im bail to know weda di court go release am afta im don dey for DSS custody since im rearrest, almost three years ago.

Wetin don happen so far

Afta dem rearrest Nnamdi Kanu for June 2021, di Nigeria goment drag am bifor Justice Binta Bukar wit 15-count charge wey im plead not guilty to.

Kanu defence counsel, wey Mike Ozekhome (SAN) bin dey lead, bin apply make di court strike out all di charges against Kanu.

However Justice Binta Bukar strike out seven of di charges but tok say Kanu get case to answer for di remaining eight.

Di Seven charges wey remain for Nnamdi Kanu to answer na:

- Terrorising pipo thru im broadcasts
- Terrorising pipo by issuing terror threats and forcing pipo to sit at home
- Being di leader of Ipob wey be group wey goment don ban as illegal organisation
- Spreading message make pipo kill security operatives
- Spreading message make pipo begin threaten and intimidate police officers
- Spreading inciting message wey lead to destruction of property belonging to di federal goment for Lagos State
- Secretly importing a radio transmitter and hiding it in Ubuluisiuzor community for Ihiala Local Goment for Anambra State

Di eight charges wey di court strike out include:

- Using radio Biafra to incite di public to attack security operatives.
- Using radio Biafra to incite di public to kill security operatives.
- Using Radio Biafra to instruct Ipob members to construct explosives.
- Inciting di public to scatter di Anambra governorship election for November 2021.
- Inciting di public to destroy goment buildings and property.
- Using terror and intimidation to force pipo to sit at home for May 31, 2021.
- Inciting pipo to do violent protest against di federal goment
- Inciting pipo through live broadcasts to go and destroy buses and transport facilities of di Lagos State goment, wey lead to serious economic damage for di state.