You are here: HomeAfricaBBC2024 04 11Article 1925722

BBC Pidgin of Thursday, 11 April 2024

Source: BBC

‘Dem bin dey call me dirty man before I blow’

Oga Maidi dey pray say im company go grow bigger Oga Maidi dey pray say im company go grow bigger

Abubakar Ibrahim Maidi na success tori wey dey inspire a lot of young pipo inside Kaduna state for Northwest Nigeria.

E bin start im Mega Recyclers company from inside im house many years ago wia e dey pick nylons and oda doti dey keep for recycling.

“Wen I bin start some pipo dey call me baban bolar (dorty man) but now I thank God for level wey I don reach employing several pipo and making a name for myself.”

“We dey pick dirty and wastes from all over and we dey recycle am into meaningful items.”

“Wetin dey make me happy be say some of di pipo wey I employ na widows wey no get who to helep dem, if dem bring waste to me I give dem money to go solve one or two problems.”

Oga Maidi dey pray say im company go grow bigger so dat e go fit employ and train more pipo as goment alone no fit provide all di jobs to pipo.

“As you can see we dey train many pipo and employ many as well if we fit get goment support we go do more.”