You are here: HomeAfricaBBC2024 04 05Article 1924666

BBC Pidgin of Friday, 5 April 2024

Source: BBC

Bobrisky and EFCC to battle for court ova naira abuse and alleged N180 million money laundering

Bobrisky go appear for court on Friday Bobrisky go appear for court on Friday

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) dey carry Idris Okuneye wey dem know as Bobrisky go court ova case of money laundering and spraying of naira notes.

Bobrisky go appear for court on Friday to face six count charges wey surround money laundering and di abuse of di naira plenti times.

According to di charges wey EFCC sama Bobrisky, dem say im tamper wit di sum of N400,000 wey im spray while im dey dance for one social event wey happun for Lekki area of Lagos on 24 March 2024.

Di prosecutor Rotimi Oyedepo, SAN, with seven oda lawyers also charge Bobrisky sake of say im tamper wit di sum of N50,000 wey im spray for Ikorodu between July and August 2023 wen im dey dance for one social event.

EFCC also accuse Bobrisky of spraying N20,000 for one event for Ikeja while dancing for December 2023 and anoda N20,000 for Victoria Island area of Lagos.

Di prosecutors say di offence of naira abuse wey Bobrisky commit dey against di Central Bank Act 2007 and e dey punishable under section 21(1).

Bobrisky gbege wit money laundering

Di mata enta money laundering as EFCC say Bobrisky dey trade but im no submit a declaration of di activities of im company.

For di number five and six count charges, EFCC say Bobrisky commit offence wey dey contrary to Section 6(1)(a), and Section 19(1) (f) of di Money Laundering (Prevention And Prohibition) Act and punishable under Section 19 (2) (b) of di same Act.

EFCC say Bobrisky get one company wey dem pay about N127.7 million inside and im no submit di activities to di Special Control Unit Against Money Laundering between September 2021 and April 2024.

For di last count charges wey EFCC sama am, Bobrisky no submit di declaration of di activities of im company wen anoda N53 million enta im account again.