You are here: HomeAfricaBBC2024 04 04Article 1924521

BBC Pidgin of Thursday, 4 April 2024

Source: BBC

Armed robbers kill SA footballer for fuel station, steal im car

Defender Fleurs join Kaiser Chiefs last October Defender Fleurs join Kaiser Chiefs last October

South African footballer Luke Fleurs don die.

Im team say dem shoot am dead for one car hijacking situation.

Di shooting happun for one petrol station on Wednesday night for Johannesburg suburb of Florida.

Di 24-year-old bin dey wait to buy fuel wen unknown gunmen approach am and order am to get out di vehicle.

One of di suspects run comot di scene wit Fleurs car afta di shooting.

Kaizer Chiefs, one of di most popular clubs for di kontri and 12-time league champions, describe im death as "tragic".

Di club say police dey handle di mata and dem go communicate further details in due course.

Sports Minister Zizi Kodwa tok say im dey "saddened say yet anoda life don dey cut short sake of violent crime".

Defender Fleurs join Kaiser Chiefs last year. E previously play for SuperSport United.

E neva play for di senior national team yet, but report dey say im dey near im debut.

On dia website, Kaiser Chiefs describe Fleurs as "classy defender" wit "great technical abilities".

E start im career for 2013 for di Ubuntu Cape Town Academy, according to local media.

Di Premier Soccer League say one minute silence go dey observed for all top-flight and second-tier games dis weekend in memory of Fleurs.

"We wake up to di heart-breaking and devastating news of di passing of dis young life," South African Football Association president Danny Jordan tok for one statement.

"Dis na huge loss for im family, friends, im teammates and football in general."

Football fans don enta social media to mourn am.

"Di football family don lost a bright flame," soccer presenter Carol Tshabalala post on social media platform X.

South Africa dey grapple wit increasing gun violence, wit several mass shootings reported in recent years.

Di kontri get one of di world highest murder rates, according to police data.