You are here: HomeOpinionsArticles2013 02 01Article 263865

Sports Features of Friday, 1 February 2013

Source: Ibitoye Shittu

Tori for Pidgin: No bribe from Ghana

De pipu wey dey control futball for Ghana (na Ghana futball Associason be dia name) don vex reply dat Ghana no do any magamago for dia lass group match wey dem wire Niger 3-0.

Na for dia website na im de Associason take tok am say dem no bribe any Niger playa bifor dem play dia match.

“We don hear de report wey de Ghana News Agency (GNA) and Radio Gold bin dey carry dat we don attempt to bribe a Niger playa bifor de match wey we play against Niger lass Monday, but dat report na lie as we no do so," Naso Ghana FA tok for dia website.

Na two amebo dem wey dey work for Ghana News Agency and Radio Gold wey be Veronica Commey and Nana Darkwa bin report for Port Elizabeth dat Ghana wan do wayo for Afcon.

“We no dey happi at all with dat report and we no go gree make dem spoil our image or cos gbege for our playas as na how we go take bulala Cape Verde on Saturday for de kwatafinal na im we dey think,” Naso de Ghana FA tok.