You are here: HomeAfricaBBC2023 10 05Article 1857182

BBC Pidgin of Thursday, 5 October 2023

Source: BBC

‘Why I dey pursue Tinubu certificate for Chicago state university’

Tinubu and Atiku Tinubu and Atiku

“Di certificate wey Nigeria President Bola Tinubu submit give di kontri electoral body na fake.”

Dis na wetin one lawyer to di Presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar for di 2023 general elections allege.

Di lawyer, Kalu Kalu for one press conference wey oga Atiku Abubakar organise afta Chicago State University release di President academic record give am, claim say President Tinubu submit forge di degree certificate e submit give di Independent National Electoral Commission (Inec) ahead of di election.

Although di presidency and im supporters don deny di allegations of forgery.

Lawyer Kalu explain say di documents di university release back im claims say e dey forged.

Kalu explain wetin dey di document

Kalu explain say di documents show say “One, dat Bola Ahmed Tinubu forge di certificate e present give Inec.

“Two, di name wey dey di qualifying certificate from South West College to Chicago State University na woman name wey show say no Bola Ahmed Tinubu get di document.

“Three, di Chicago State University admission form claim say Bola Ahmed Tinubu attend Government College Lagos and graduate for 1970 when indeed dem establish di school doe 1974.

“Di same document show say di owner of dat document na black American and (in) di document wey Bola Ahmed Tinubu submit to Inec, e deny say im no get dual citizenship, wey mean say no be him get di document. Then, di same document, oral deposition, tok say di A in Bola A Tinubu na Ahmed but di NYSC certificate wey Bola Ahmed Tinubu submit give Inec get Adekunle. I no know wia Adekunle emerge from.”

Na Gani Fawehinmi ginger me to go afta Tinubu certificate - Atiku

Anticipation high afta tori spread say former Nigeria vice president wey also be di candidate of di Peoples Democratic Party(PDP) Atiku Abubakar go address world press conference on Thursday, 5 October.

Many Nigerians bin dey expect say e go address di outcome of di suit e file against President Bola Tinubu ova im academic record for di Chicago State University.

Wen tori pipo ask am to react to di documents wey CSU release afta di suit e file, na one of im lawyers e allow to react to di mata.