You are here: HomeAfricaBBC2023 10 11Article 1860341

BBC Pidgin of Wednesday, 11 October 2023

Source: BBC

‘Pipo wey no sabi something dey see Nigerians as certificate forgers’ – Oda tins Peter Obi tok about Atiku vs Tinubu matter

Tinubu and Peter Obi Tinubu and Peter Obi

Presidential candidate of Labour Party Peter Obi say im no dey happy wit di kain questions wey pipo dey ask am about Nigeria.

Oga Obi na one of di major candidates for di 2023 presidential elections for Nigeria wey President Bola Tinubu win.

Peter Obi for one press conference e do on Wednesday, chook mouth inside di controversy wey concern di Atiku Abubakar vs Chicago State university matter wey dey demand details of di academic record of di Nigerian president.

For di briefing e say im dey embarrassed by di way pipo dey see Nigerians.

“Uninformed outsiders now see Nigerians as fraudsters, certificate forgers and identity thieves” - Peter Obi tok

E add say "Make oga Tinubu tell di nation and di world who im truly be. Make e tok im real name, im age, im nationality, di school wey e go and university wey e go and di certificate wey e collect.”

Di LP candidate tok say if at all Tinubu bin do change of name, make im tell Nigerians about am.

Obi tok say sake of di highest office wey Tinubu occupy for Nigeria, im no get right to any privacy regarding im identity.

"Pipo deserve to know for certainty di true identity of dia leader, dis override whatever right di leader fit get to personal privacy," Obi tok.

E tok say mata of personal identity of a leader too dey central to di function of di office wey e currently occupy.

Evidence no dey say di diploma wey Nigeria President Bola Ahmed Tinubu submit to di kontri electoral commission na fake, di BBC Global Disinformation Team don find out.

Allegations say President Tinubu certificates na fake bin go viral on social media after di Chicago State University (CSU) release im academic records last week.

Dem release im records to di candidate of di Peoples Democratic Party Atiku Abubakar wey wan use am support im case against Tinubu for Supreme Court.

During one press conference last week after, Atiku bin call on Obi, Rabiu Kwankwaso, and other Nigerians to join am as im demand for dis legal battle.

“I go only drop di fight wen di court rule. If di court rule say I dey right, fine. If di court rule say im dey right, fine,” Atiku tok.

“So dat na di end of di fight, sake of say at di moment we dey Supreme Court and e no get higher court dan di Supreme Court."