You are here: HomeAfricaBBC2023 11 21Article 1884926

BBC Pidgin of Tuesday, 21 November 2023

Source: BBC

‘Nigeria dey very hard to lead but I try my best'

Former president of Nigeria Muhammadu Buhari Former president of Nigeria Muhammadu Buhari

Former president of Nigeria Muhammadu Buhari don come out to tok wetin im eyes see for office for di eighth years wey im lead di kontri.

Buhari tok say to comot office afta eight years na very happy experience for am sake of say im get enof time to attend to im farm.

For di interview wey di former president do wit NTA, e reveal say im no too miss anytin for office but e dey grateful say e get di opportunity to lead Nigerians.

“I bin look forward to comot office and I dey happy say I get am. I come back my village, I dey go my farm and do exercise as I dey see di animals. I wake up wen I like and I come out wen I like.”

“I no too miss anything much for office. Even as pipo get dia own opinion, I still thank God becos na im give me opportunity to serve my pipo and my kontri,” Buhari tok.

Former president Buhari add say e do im best but "either e dey good enof dey pipo hand to decide."

Since Buhari comot office, plenty pipo don begin dey ask wetin im achieve for di eight years wey im spend for office.

For im reply, former president Buhari tok say im fight corruption and insecurity.

“I fight insecurity, di economy and fighting corruption, na di three tins wey I set out to do especially for Northeast wey be say na di hand of Boko Haram e dey.”

‘I no take Nigeria for granted’

Buhari say im dey dedicated to Nigeria wen e dey office wey no make am get time to dey face external problem.

Di former president explain say nobody fit lead Nigeria make e no dey accountable and im gatz dey competent enof to lead.

E add say leading Nigeria dey extremely difficult becos say pipo sabi dia right.

“I dey so occupied wit di local problem wey be say I hardly think about di external problem aside di closure of border wey dey important to monitor and e dey natural for kontris wey wan develop.”

“You no fit lead a kontri like Nigeria make you no dey accountable becos e help to build institutions and employ pipo. We gatz dey struggle day and night to show say we dey competent enof and pipo dey feel say na dem suppose dey di position no be you but I neva take Nigeria for granted,” Buhari tok.

‘Nigerians dey clever’

Wen former president Buhari bin dey struggle to enta office for, one of im campaign word be say im no get any hidden properties anywia and e maintain say im become overcareful make Nigerians no go drag am.

E say im don dey leave in peace for di past 6months now wey e comot office as president.

“I no build any house, I no acquire any company and I no dey compete wit Nigeria. Na why I dey live in peace for over 6months now. Nigerians get how dem go find out and arrest pipo wey don cheat dem. “

“Nigerians dey clever, dem go encourage you to make one mistake and you go fit explain becos dem go hold you. Na why I dey overcareful so pesin no go say ‘oga’ you get one account for Saudi Arabia or somewia,” Buhari say.

‘I choose di crazy tin’

While speaking on how e contest many times bifor im finally win as president, Buhari reveal say plenti pipo bin laff at am instead make dem sympathise wit am.

E also tok on di naira policy wey affect di economy but Buhari say na becos say Nigeria still dey stage of development na why di issue dey hard.

Di former president say joining di army na crazy tin and im choose to do di crazy tin.

“Pipo bin laff at me wen I start to dey contest, instead make dem sympathise wit me but technology come and na only one PVC pesin dey get to vote. Naso I win.”

“To go into di military na very crazy tin, and I choose di crazy tin bifor I come contest for election.”

‘Nobody dey above di law’

Speaking on cabal wey surround di last administration, Buhari say nobody hijack im administration as e no allow make anybody use public fund for personal use.

“If pipo say I dey surrounded by corrupt pipo, na dia problem be dat. I no dey allow anobody use public resources for himself or for me. Nobody dey above di law and I no get any evidence of any offenders wey waka comot.”

Buhari say nothing much to change for Nigeria sake of di kain multi-party democracy wey di kontri dey practice. E say some pipo wan dey try do tins wey dem go get away wit but im administration no allow ma.

“Much no go dey for me to do differently under dis system. Na multi-party democracy dey cause some wahala wia some pipo wan do wetin dey wan do and still get away wit it.”