BBC Pidgin of Thursday, 12 February 2026

Source: BBC

Kim Jong Un choose im teenage daughter as heir, Seoul tok

North Korea leader Kim Jong Un don choose im daughter as im successor North Korea leader Kim Jong Un don choose im daughter as im successor

North Korea leader Kim Jong Un don choose im daughter as im successor, South Korea spy agency tell lawmakers on Thursday.

No much information dey about Kim Ju Ae, wey for recent months don dey appear beside her papa for high-profile events like visit to Beijing for September – na her first known trip go abroad.

Di National Intelligence Service (NIS) say dem consider "different circumstances," including how she don dey show face more for official events befor dem reach dat conclusion.

Di NIS add tok say dem go dey monitor closely weda she go attend the North party congress later dis month – di biggest political event wey dem dey hold once every five years.

Di party congress na wia Pyongyang bin expect to give more details about priorities like foreign policy, war planning and nuclear ambitions for di next five years.

On Thursday, lawmaker Lee Seong-kwen tell reporters say befor, NIS bin describe Miss Kim as person wey dem dey "train" to bicom successor, but now she don reach di stage of "successor designation."

"As Kim Ju-ae don show her presence for different events, including the founding anniversary of the Korean People's Army and her visit to di Kumsusan Palace of di Sun, plus signs don show say she don dey voice her opinion on some state policies, NIS believe say she don enter di stage wia dem don designate her as successor," Lee tok.

Kim Ju Ae na the only child wey pipo know say Kim Jong Un and im wife, Ri Sol-Ju, get. NIS believe say Kim get older son, but dem never acknowledge am or show am for North Korean media.

News about her existence first come out through unexpected source - basketball player Dennis Rodman, wey tell The Guardian newspaper for 2013 say he "carry dia baby Ju Ae" during one trip go the secretive country.

Ju Ae wey dem believe say she dey around 13 years, first appear for state television in 2022, wia dem show am dey inspect North Korea latest intercontinental ballistic missile while she hold her father hand.

Since den, she don dey appear often for state media, helping soften di image of her father wey many pipo see as ruthless dictator. She even follow am go Beijing for China biggest military parade ever, wia pipo see her dey step down from im armoured train for Beijing Railway Station.

Many times dem dey see her wit long hair - sometin wey dey forbidden for her mates and she dey wear designer clothes wey most pipo for her country no fit afford.

Anoda lawmaker, Park Sun-won, say di role wey Miss Kim don take during public events show say she don start to contribute to policy decisions and dem dey treat her like di de facto second-highest leader.

Power for North Korea don pass through three generations of di Kim family, and many pipo believe say Kim go hand over leadership to one of im children.

For recent months, dem show her dey stand taller dan her father and walk beside am instead of following behind.

For North Korea, wia photos wey state media publish dey carry strong symbolic meaning, e rare well well for anybodi aside Kim to appear as prominently as am inside pictures.

Even though South Korea spy agency now believe say Kim Ju Ae na di person wey dem don choose to take over, e still dey raise plenty questions.

E dey confusing why dem go pick Ju Ae, wey be daughter, as heir pass older son for North Korea wey get strong male-dominated culture. Plenty defectors and analysts bin don tok befor say make woman lead North Korea no really likely, bicos traditional gender roles strong well well for di kontri. But Kim sister Kim Yo Jong don show say woman fit still hold power for di regime.

Ms Kim dey currently hold senior position for di Central Committee of di Workers' Party of Korea, and report say she get influence over her broda.

However, e still be mystery why Kim, wey still young and look healthy, don already dey choose 13-year-old pikin as heir from now.

Nobodi clear about di kind changes wey Ju Ae succession go bring to North Korea. Plenty North Koreans bin hope say Kim Jong Un, wey be young man wey study for Western kontris, go open di country to di outside world wen e succeed im father.

But dat hope no happun. Any plan wey dis teenager get for her kontri, she go get full power to shape am exactly how she like.