BBC Pidgin of Tuesday, 10 February 2026

Source: BBC

Nigeria rank low pass Mali, Niger Burkina Faso odas for latest corruption rating

Nigeria dey rank low pass several African kontris for di Corruption Perceptions Index 2025 Nigeria dey rank low pass several African kontris for di Corruption Perceptions Index 2025

Nigeria dey rank low pass several African kontris for di Corruption Perceptions Index (CPI) 2025 ranking wey dem just release.

For di ranking, na about 182 kontris take part and wia 122 kontris score below 50.

According to Transparency International, di organisation wey dey incharge of di ranking, na only five kontris score above 80 out of 100 score.

Kontris for Africa bin also follow for di ranking, wia Cape Verde or Cabo Verde wit 62 score na di highest ranked African kontris for 35th position.

Botswana and Rwanda follow for 41st position wit 58 score while some oda African economies score low.

Nigeria dey for di 142 position wit 26 score out of 100, Niger dey 124 position wit 31 score, Kenya dey 130 position wit 30 score, Burkina Faso dey 84 position wit 40 score.

According to di ranking 100 score na di highest and e mean veri clean while 0 score mean highly corrupt.

Full list of all di kontris for di corruption index, dia score and rank bin dey below dis story.


  • Click Here To Join BBC News Pidgin Whatsapp Channel
  • Ex-Nigerian oil minister no take bribes from industry insiders, Alison-Madueke lawyer tell court
  • How court martial dey work for civilian govment and wetin go happun to Nigerian coup plotters

Transparency International say 36 out of di 50 biggest kontris wey drop for di CPI p restrict freedoms, wia ova 90 per cent of journalists dey murdered sake of investigation into corruption.

According to Maíra Martini, di CEO of Transparency International, leaders for different countries gatz provide betta future for dia citizens.

"Di world need accountable leaders and independent institutions to protect di public interest more dan eva."

Di organisation say make leaders bin make political finance transparent and protect media freedom.

Di Transparency International 2025 Corruption Perceptions Index dey measure levels of public-sector corruption in 182 countries.

For di 2025 ranking, di number of countries wey score above 80 bin reduce from 12 go five wit di worry say countries of democracies dey witness corruption.

According to di CPI, dem say corruption remain serious threat for evri part of di world.

Part of di reason wey dem give na abuse of power, attacks on independent civil society including di anti-govment protests for many parts of di wey dey show say pipo don taya for bad leadership.

Full list of countries for di Corruption Perceptions Index (CPI)


  • Popular Ghanaian socialite wey dey face $8m romance scam for US sue FBI and odas for alleged abuse
  • Court give reason why e reduce Ghana former fetish priestess 'Agradaa' jail term from 15 years to 12 months
  • Di three West African juntas wey US wan engage afta dem bin turn to Russia