BBC Pidgin of Wednesday, 17 December 2025

Source: BBC

Police arrest popular Tiktoker Peller over reported attempted suicide

Police for Lagos don arrest and detain Habeeb Hamzat alias Peller Police for Lagos don arrest and detain Habeeb Hamzat alias Peller

Police for Lagos don arrest and detain Habeeb Hamzat alias Peller say e try commit suicide.

For statement Lagos police tok tok pesin Abimbola Adebisi say dis dey come afta dem see video wey show di content creator dey drive anyhow, and put im life and dat of oda road users in danger.

Tori bin comot on sunday say di popular TikToker get accident and dey hospitalized. Videos wey trend online show wia Peller dey cry and drive and also dey stream di adventure live.

Police say im action constitute "deliberate attempt to commit suicide and endanger life of oda innocent pipo".

"We dey investigate di matter for di State Criminal Investigation Department (Scid). We go make di outcome of di investigation open to di public and we go charge di suspect to court in accordance to di law.

Di state say di Commissioner of Police for Lagos dey warn content creators make dem no dey endanger dia life and dat of oda citizens in di name of content creation.

Earlier di Federal Road Safety Commission say dem dey monitor di situation and plan to prosecute Peller sake of di incident.

How di inciden happun

Di incident hapun on Sunday for Lekki Epe expressway for Lagos.

Peller, wey dey alone inside im Mercedes-Benz, show signs of distress as e dey also tok emotionally for phone call.

During di livestream, Peller tok say, "I go use dis car crash now," befor e add say, "I dey scared. I dey scared."

Di livestream show say later, e drive off and crash im car into one stone barrier, wey cause serious damage to di vehicle.

Photos and videos from di crime scene show im crashed car and wen pipo gather to pull am out of di car.

Peller na popular Tik Tok live streamer for Nigeria wit millions of fans on dat platform and across im oda online platforms.

E never clear why di young content creator involve imsef for dat kain activity.

Suicide na criminal offense for Nigeria and dey punishable by minimum of one year imprisonment.