BBC Pidgin of Wednesday, 17 December 2025

Source: BBC

'I know say I give my best' - Ahmed Musa tok as e retire from International football

Super Eagles Captain, Ahmed Musa don announce im retirement Super Eagles Captain, Ahmed Musa don announce im retirement

Super Eagles Captain, Ahmed Musa don announce im retirement from international football.

Di former Kano Pillars forward announce im retirement on Wednesday for im Instagram page.

Musa wey play for di Super Eagles for 15 years tok say "I bin wear dis badge wit pride for 15 years."

Im say na from wen im bin dey 17 years old as a boy na wen im begin to ansa evri call to Nigeria.

Di Nigeria calls wey im respond to make am to be di most capped Super Eagles player wit 111 appearances as im rise to becom captain of di Super Eagles.

Musa say during im time for di Super Eagles im be "Captain, Servant, Believer" and im also give evritin.

" ...my heart go always beat green" e add.

During im time for Super Eagles e win di Africa Cup of Nations. E also become di highest goalscorer for Nigeria for World Cup as e score five goals

Ahmed Musa for Super Eagles

Di Nigerian winger wey from Plateau State become di first Super Eagle player to score more dan once for Fifa World Cup.

Dis na afta e score two goals against Argentina for di 2014 Fifa World Cup.

Im also be di first Nigerian to score two goals for Fifa World Cup.

Ahmed Musa play for Nigeria under 20 and under 23 teams bifor e join di Super Eagles.

Between 2010 to 2025 Musa score 16 goals for Nigeria