BBC Pidgin of Tuesday, 16 December 2025

Source: BBC

Ex-Chief Justice of Nigeria Tanko Muhammad don die

Former Chief Justice of Ngeria, Justice Tanko Muhammad don die Former Chief Justice of Ngeria, Justice Tanko Muhammad don die

Former Chief Justice of Nigeria (CJN) Justice Tanko Muhammad don die.

E pass on about two weeks bifor im 72nd birthday on December 31.

Bauchi State Govnor Bala Mohammed wey confam im death, tok say Oga Muhammad die on Tuesday, 16 December for one hospital for Saudi Arabia afta one prolonged illness.

For statement wey di govnor tok-tok pesin Mukthar Gidado sign, e describe di ex-CJN as "correct jurist wey im life and career show dedication to duty, integrity in service, and steadfast commitment to di rule of law."

"Na wit profound sadness and deep sense of loss im Excellency, Sen. Bala Abdulkadir Mohammed CON, Fnipr ( Kauran Daular Usmaniyya ) di Executive Govnor of Bauchi State, on behalf of im family, di govment plus di good pipo of Bauchi State, join all Nigerians to mourn di sudden passing of Honourable Justice Ibrahim Tanko Muhammad, GCON, ogbonge son of our great state, wey die today for Saudi Arabian hospital afta one prolonged illness," di statement read.

Di ex-CJN die nearly three and a half years afta e resign from office on health grounds on 27 June 2022.

Im resignation for June 2022 bin come18 months earlier dan im scheduled retirement at age 70 on 31 December 2023.

Oga Muhammad wey be Nigeria 18th chief justice, bin enta office as di oga patapata of di Nigerian judiciary afta di controversial suspension of im predecessor, Walter Onnoghen for January 2019.

E dey di office for three years and five months.

Im sudden exit from office for June 2022 come for di middle of one serious crisis for di Supreme Court, afta 14 of im colleagues accuse am say e no dey fund judges welfare.

Who be Tanko Muhammad

Dem born Justice I. T. Muhammad for 31st of December 1953. E come from Doguwa, Giade Local Government Area of Bauchi State.

E get all im Law degrees wey include LLB, LLM and PhD from Ahmadu Bello University, Zaria.

E rise through ranks, from di position of Magistrate Grade II to become di Chief Justice of Nigeria.

Di Bauchi State govnor tok say di, "judge rise through di legal profession wit diligence and distinction, e serve wit honour as Judge of di High Court, di Court of Appeal and as Justice of di Supreme Court of Nigeria."

Late ex-president Muhammadu Buhari bin appoint am acting CJN on 25 January 2019, afta ova six months in acting capacity, Buhari swear am in on 24 July, 2019 as di substantive 18th Chief Justice of Nigeria (CJN) for di State House for Abuja.