Dem don find legendary Hollywood actor and filmmaker Rob Reiner and im wife Michele dead for dia Los Angeles home, according to BBC news partner CBS.
Police dey torchlight di incident as a case of homicide afta police and firefighters get call to one house for di Brentwood neighbourhood on Sunday evening.
As dem dey reach, authorities see one 78-year-old man and 68-year-old woman – say two of dem don die for dia house.
Officials no immediately identify dem or wetin fit don lead to dia death.
Reiner na ogbonge Hollywood filmmaker wey im feems include classics like The Princess Bride, When Harry Met Sally, and This is Spinal Tap.
Tok-tok pesin for di Los Angeles Fire Department tell di BBC say dem bin get call around 15:38 local time (23:38 GMT) for medical aid to one house Chadbourne Avenue.
Brentwood na rich pipo area for LA and home to many celebrities.
Robbery homicide detectives from di LA police department also respond to di home and don open homicide investigation.
Once inside di residence, police say dem see two pipo wey don die, but dem provide further details on wetin cause dia death.
For press conference on Sunday night, police say dem go conduct conduct full crime scene investigation for di residence in di coming days.
Dem neva detain any suspect for questioning and dem no dey find any pesin of interest, dem add.
Police no give details about any injuries di two get and say di cause of death go dey determined by di LA coroner office.
California Governor Gavin Newsom release statement for social media wey confam di death of Reiner and im wife.
Newsom say im dey "heartbroken" by di death and call Reiner a "big-hearted genius behind so many of di classic stories we love".
LA mayor Karen Bass call Reiner death a "big loss for our city and kontri", and pay tribute to di couple charity work for childhood development and LGBTQ+ advocacy.
Reiner, wey be TV star in di 1970s play Meathead for di groundbreaking comedy All in The Family, bin marry actress Penny Marshall from 1971 to 1981. Im na di adoptive father to Marshall daughter, actress Tracy Reiner.
E later marry Michele Reiner, actress and photographer, in 1989. Di couple get three children togeda, Jake, Nick and Romy.











