BBC Pidgin of Wednesday, 3 December 2025

Source: BBC

Nursery worker admit say im sexually abuse children under im care

Vincent Chan bi nursery worker Vincent Chan bi nursery worker

One nursery worker don confam say im sexually abuse young children for im care for north London.

45-year-old Vincent Chan bin appear for Wood Green Crown Court wia e plead guilty to 26 charges wey include sexual assault by penetration, sexual assault by touching and say e make indecent images wey show di most severe category of child sex abuse.

Di investigation into Chan bin come afta a tip-off from one whistleblower and e become one of di most "harrowing and complex" cases wey di Metropolitan Police go carry out, di force tok.

Dem go sentence Chan of Stanhope Avenue for Finchley, on 23 January.

'Deeply disturbing material'

Judge David Aaronberg KC tell di defendant say: "Mr Chan, you don plead guilty to mata wey go result in a custodial sentence of many years."

Chan become pesin of interest afta e face allegation say e film children for Bright Horizons nursery, Finchley Road, West Hampstead. Di nursery branch don close since den.

Wen police begin dey investigate, dem discover wetin detectives call "deeply disturbing material" for Chan devices and iPads wey dem seize from di nursery.

Dem later see di video evidence of sexual abuse of children for di nursery, some wey dem feem for di nursery iPads.

Det Supt Lewis Basford, wey lead di Met Police investigation, tok say di offences don cause "deep shock and distress".

Di Disclosure and Barring Service bin don evaluate and vet Chan as e don work as karate club instructor and for one school before.

Chan, wey dem born and raise fir UK dey of Chinese heritage. E bin serve for some roles for di nursery wey include art specialist, room leader and nursery nurse.

E dey in charge of di care of children aged between two and four.

Family members of many of di victims bin sidon for di dock as dem read out di charges, many of dem bin shed tears.

Following Chan guilty pleas, di victims parents bin make joint statement through dia solicitor.

"As parents we still dey try to process di sickening discovery say our children bin dey subjected to despicable abuse... We feel say Bright Horizons don fail us, and we want answers.

"How dem take employ pesin like Vincent Chan? And how dis kain horrific crimes against children take hapun and continue for so long and di staff wey dey responsible for safeguarding for Bright Horizons nursery no do antin about am?

"We dey concerned say dis failures in management and supervision for Bright Horizons allow dis abuse to go undetected, and we dey committed to secure accountability for our children."

One tok-tok pesin for Bright Horizons tok say: "We dey shocked and appalled by dis individual horrific crimes. Our thoughts first and foremost dey wit di children and families wey dey affected, and we dey committed to offering support to dem during dis incredibly difficult time."