Dem find dis 20-day-old baby girl wey dey bury alive and e dey fight to survive, according to wetin hospital authorities say.
Na one shepherd wey dey carry im goats go di area to go find food bin hear her voice by chance for wia she dey.
As di shepherd hear her faint voice, na under earth she bin dey cry from wit tiny voice.
Wen di shepherd bin go closer, e see di tiny hand of di little baby dey stretch out of di mud wia dem bury her.
E immediately alert di pipo wey dey live for di village, and dem call di police wey later come dig out di baby from di mud wey she dey.
Police neva tok who dem dey suspect for di crime to bury di baby for mud. Di incident happun for for di northern Indian state of Uttar Pradesh.
Meanwhile, similar cases to dey abandon and attempt to kill female children dey blamed on di culture for India wia dem dey prefer sons, and dis dey widely acknowledged to be di reason why di kontri no get balanced gender ratio.
Dis incident wey don cause tok tok bin happun for one place for Shahjahanpur district for India most populous state.
Dem don carry di baby go hospital wia dem dey treat her for di neonatal intensive care unit of di govment-run medical college and hospital.
Medical college principal Dr Rajesh Kumar tell di BBC say dem bring di baby come few days ago and e dey cova wit and dey gasp for air as mud don go into her mouth and nostrils.
"She dey for critical condition, she bin dey show signs of hypoxia or oxygen deficiency. Insects and also some animal don bite her," Dr Kumar say.
Di doctor add say, "Afta 24 hours we see minor improvement for her condition, but she e dey go worse. She don develop infection."
Dr Kumar say e believe say dem just bury di baby wen dem find her sake of say her "wounds dey fresh".
Team of doctors, wey include plastic surgeon dey treat di baby and dem dey try to control her, di doctor confam.
Dr Kumar say, "Di medical condition dey veri serious, but we dey try our best to save her."
Howeva, one police official say dia attempt to track down di parents of di baby neva dey successful yet.
According to di officials, di child helpline for di state don dey informed about di situation of di baby.
Di incident for Shahjahanpur, India no be di first time dem go leave female baby to die for India.
For 2019, di BBC report on premature newborn baby wey dem find for wia dem bury am alive for inside clay pot. Afta weeks for di hospital, doctors say she bin recova.
India dey known to get one of di worst gender ratios for di world. Women dey face lifelong social discrimination and dem dey see girls financial burden, particularly among poor communities.
Campaigners say traditional preference for sons mean say millions of female children dey to lost to foeticide and infanticide ova di years.
Although most unwanted female foetuses dey aborted wit help from illegal sex determination clinics, cases of baby girls wey dem dey kpai afta birth no too uncommon











