South Africa govment don warn young women say make dem no fall for social media recruitment scam wey dey promote job opportunities for abroad.
Dis dey come as plenty online videos wey South African social media influencers dey push to advertise jobs for young women for Russia don go viral.
Di authorities dey torchlight one promotional video wey one influencer Cyan Boujee promote, she don comot di video now from her account. She bin describe two-year "start programme" for young women for di beginning of dia careers wey wan get professional skills.
Plenty young pipo for South Africa dey jobless and many of dem dey desperate for work.
For Boujee video – wey dem shoot for Tatarstan for Russia – dem show viewers di accommodation wey di pipo wey dem employ go dey stay.
Di influencer, wey her real name na Honour Zuma, describe di programme as "fresh new start" she add say "clearly dem dey treat girls fairly for here – Africans, Asians, Latin Americans".
Boujee, wey get 1.7 million TikTok followers, also explain say those wey dem hire go get jobs and dem go teach dem how to speak Russian.
E neva clear di work wey di young women go dey do, but di programme wey she advise target women aged 18 to 22.
Suggestion no dey say Boujee don do anything illegal, she also neva respond directly to di criticism wey she face ova di weekend.
One of her most recent Instagram posts show her on one plane, dey drink champagne, and she say: "Legs stretched, champagne poured, drama ignored."
Di South African government dey "extremely worried" to see as dem dey use influencers to promote jobs abroad, according to di kontri head of public diplomacy Clayson Monyela.
For one X post, e warn young pipo, especially girls, "say make dem no fall for unverified foreign job offers", especially di ones dem dey promote on social media.
"If something look too good to be true, get a 2nd opinion," e write.
Allegations don dey ground say some pipo wey dem recruit to go work for Tatarstan bin end up working in a weapons factory, wia dem dey make drones wey dem dey use for di Russia war in Ukraine.
One of di main recruiters na one special economic zone for Tatarstan, wey be wia pipo believe say dem dey produce these weapons.
One report by di Global Initiative Against Transnational Organized Crime wey dem release for May bin chook eye into di recruitment of pipo for di "start" programme.
Dem tok say di "dem dey entice potential recruits to participate under false pretences on top di nature of di work, di working conditions and opportunities for education", e add say di objective na to support di "drone production programme".
Most of dem dey work "directly in drone production, while odas dey work as support staff – cleaners and caterers".











