BBC Pidgin of Friday, 28 March 2025

Source: BBC

Police ban Durbar in Kano for dis year Salah festival

Sanusi Lamido Sanusi/Aminu Ado Bayero Sanusi Lamido Sanusi/Aminu Ado Bayero

Di Kano state Police Command don cancel Salah Durbar, wey be festival wey dem dey do during Muslim Eid celebration for Kano, Northern Nigeria for dis year.

Dem announce dis one for press briefing wey Kano Commissioner of Police, CP Ibrahim Adamu Bakori, do for Bompai Police Headquarters on Friday.

CP Bakori tok say dem take di decision afta dem check and analyse di security situation for di state, especially as tension dey rise and uncertainty dey around di Durbar activities, particularly wit di wahala wey fit happun if dem allow am.

"As part of our collective effort to maintain peace and security, we don place ban on all Durbar activities for di whole state during the 2025 Eid-El-Fitr Sallah celebrations."

E still add say, "Dis decision come afta consultation wit di security stakeholders based on strong intelligence report wey show say some pipo don recruit miscreants and dem sponsor plan to use Durbar as way to cause trouble and scatter public peace."

E advise all worshippers make dem do dia normal Eid prayers for di places wey dem suppose do am, just as dem dey do am before, sake of say di police don already arrange enough security to make sure say everywia dey safe.

Even for di last Eid-el-Kabir wey pipo sabi as big Salah, dem still cancel di Salah Durbar, and many pipo believe say e get connection wit di Emir wahala for Kano, afta di state Govnor, Abba Kabir Yusuf, dethrone Aminu Ado Bayero from im throne.

Salah Durbar na big tradition wey thousands of people dey attend for royal horse parade for Kano, and e don dey happun for more dan 200 years. But dis year same as last year, di three-day Durbar, wey be horse parading ceremony, don dey cancelled.