Elon Musk don cause wahala sake of di one-armed gesture e do as e dey give speech to celebrate di inauguration of Donald Trump.
Musk bin thank di crowd say na "dem make am happun", bifor e put im right hand ova im heart, come push di same arm out into di air straight ahead of him.
E come turn and repeat di action for those wey dey siddon for im back.
Many pipo on X, di social medial platform wey e be di owner, don compare di gesture to Nazi salute.
In response, Musk bin post on X: "Frankly, dem need beta dirty tricks. Di 'evribody na Hitler' attack don tire."
Musk, di world richest man and close ally of President Trump, bin dey tok for di Capital One Arena for Washington DC wen e make di gesture.
"My heart go out to you. Na bicos of una di future of civilisation dey assured," di 53-year-old tok afta e give di second one-armed salute.
Di mata immediately trend on social media as pipo come for am.
Claire Aubin, one historian wey im specialty na in Nazism within di United States, say Musk gesture na "sieg heil", or Nazi salute.
"My professional opinion na say all of una dey right, you suppose believe your eyes," she post on X, in reference to those wey believe say di gesture na pure reference to Nazis.
Ruth Ben-Ghiat, one history professor for New York University, tok say: "Historian of fascism here. Na Nazi salute and a very serious one too."
Italian media report say Andrea Stroppa, one close confidant of Musk wey connect am to far-right Italian PM Giorgia Meloni, bin post di clip of Musk wit di caption: "Roman Empire is don come back starting from Roman salute".
Di Roman salute bin dey widely used for Italy by Benito Mussolini Fascist Party, bifor Adolf Hitler later adopt am for Germany.
Stroppa later delete im post, Italian media tok. E later post say "di gesture, wey some mistook as Nazi salute, na simply Elon, wey get autism, e dey express im feelings by saying, 'I wan give my heart to you'," e tok.
"Dat na di exact thing e tok wit microphone. ELON DISLIKES EXTREMISTS!"
Di gesture dey come as Musk politics don increasingly shift to di right.
E don make recent statements in support of Germany far-right AfD party and British anti-immigration party Reform UK.
But some dey defend am, wey include di Anti-Defamation League, an one organisation dem found to combat anti-Semitism.
"E be like say Elon Musk make awkward gesture in a moment of enthusiasm, no be Nazi salute," di group post on X.
Musk don become one of Trump closest allies and e dey art of pipo wey go lead wetin di president call di Department of Government Efficiency.````











