You are here: HomeAfricaBBC2023 06 03Article 1779251

BBC Pidgin of Saturday, 3 June 2023

Source: BBC

US-Israeli woman die afta 22 years she dey for coma

File foto File foto

One US-Israeli woman don die afta 22 years wey im dey for coma from injuries she suffer for one Palestinian suicide bombing for one pizza restaurant for Jerusalem.

Chana Nachenberg be 31 at di time of di attack for di Sbarro pizzeria, wey kill 15 oda pipo, including seven children and one pregnant woman.

She be di third US national to die as a result of di bombing for August 2001.

Di US dey seek di extradition from Jordan of one woman wey Israel convict of murder for her role for di attack.

For 2003, Israeli court bin give Ahlam Tamimi, one Jordanian citizen wey live for di occupied West Bank at di time, 16 life sentences. Dem release her for 2011 as part of one deal to free one Israeli soldier wey Palestinian Hamas militants for Gaza hold captive for more than five years.

Tamimi help di bomber, Izz al-Din Shuheil al-Masri, carry out di attack. She later return to Jordan afta her release, and don tok about her pride at her involvement for di atrocity.

Tamimi dey on di FBI Most Wanted Terrorists list and di US say dem wan extradite her on charges of conspiring to use one weapon of mass destruction against Americans. Jordan High Court don reject one previous request.

Di parents of one of di two oda US citizens dem kill for di attack - Malki Roth, wey be 15 at di time - don campaign for years for di US to do more to effect Tamimi extradition.

Di Sbarro restaurant, wey dey for one busy intersection for di centre of west Jerusalem, dey packed wit customers wen Tamimi and Masri, both Hamas members, enta on 9 August. Tamimi, wey choose di target, comot di place before Masri blow imself up. In addition to those wey dem kill, about 130 pipo also injure.

Na one of di multiple suicide bombings by Hamas during di second Palestinian intifada, or uprising, against Israel, wey start di year before and end for 2005.