You are here: HomeAfricaBBC2023 05 07Article 1762382

BBC Pidgin of Sunday, 7 May 2023

Source: BBC

Gunman kpai eight pipo inside mall for latest US shooting

Pipo for di scene of di incident - Reuters Photo Pipo for di scene of di incident - Reuters Photo

One gunman don soot and kill eight pipo wey dey shop inside one mall wey dey north of Dallas, Texas, na so emergency services tok.

Dem evacuate hundreds of pipo from di mall for di city of Allen, as eyewitnesses describe say one man bin dey fire indiscriminately at pipo wey dey waka pass.

Police say dem shoot di gunman die and believe e bin act alone.

Dem report some of di victims be pikin dem. At least seven pipo dey recieve treatment for hospital, three of dem critically ill.

Allen Fire Chief Jonathan Boyd tok say dem pronounce seven pipo - wey include di gunman - dead for di scene and two die later for hospital.

One police officer "hear gunshots, carry waka go wia di gunshots dey come from, engage di suspect and neutralised di suspect", Allen Police Chief Brian Harvey tok.

Di victims' age range from 5 to 51, according to one hospital toktok-pesin.

Texas Governor Greg Abbott describe di shooting as an "unspeakable tragedy" and say di state dey ready to offer any assistance to local authorities.

US police don ask members of di public wey capture video for di scene to contact di FBI, as dem dey collect evidence.

Some witnesses describe say di gunman wear all black and wear combat gear. Footage wey dem take after di gunman death appear to show one AR-15 style rifle lying near im body.