You are here: HomeAfricaBBC2023 05 04Article 1760549

BBC Pidgin of Thursday, 4 May 2023

Source: BBC

King Charles: Wetin di King dey do?

On Saturday 6 May, King Charles III go become di 40th British monarch On Saturday 6 May, King Charles III go become di 40th British monarch

On Saturday 6 May, King Charles III go become di 40th British monarch wey dem go crown for Westminster Abbey.

E become king afta im mama Elizabeth II die for September.

Wetin di King dey do?

Di King na di Uk head of state. Howeva, im powers dey symbolic and ceremonial and e dey politically neutral.

E dey collect daily dispatches from goment for red leather box wey include briefings before important meetings, or documents wey need im signature.

Di Prime Minister dey normally meet di King on Wednesday for Buckingham Palace, to tell am about goment matas.

Dis meetings dey totally private, e no dey get official record of wetin dem tok.

Di King also get some official parliamentary roles:

Appointing of goment - di leader of di party wey win general election dey usually receive call to go Buckingham Palace wia dem dey get invite to form goment. Di King dey also formally dissolve goment before elections.

State Opening and di King Speech - di King dey start di parliamentary year with di State Opening ceremony, wia im dey set out di goment plans for speech wey im go give from di throne for di House of Lords.

Royal Assent - wen piece of legislation don pass through Parliament, na di King need to formally approve am before e become law. Di last time Royal Assent bin dey refused na for 1708.

Di monarch dey also lead di annual Remembrance event for November for di Cenotaph for London.

Di King dey also host visiting heads of state - like South Africa President Cyril Ramaphosa - and dey normally meet foreign ambassadors and high commissioners wey dey based for Uk.

For im first state visit, Charles go Germany wia e become di first British monarch to address di German parliament.

Di King also be di head of di Commonwealth, di joinbodi of 56 independent kontris and na di head of state for 14 of di kontris wey dem dey call di Commonwealth realms..

Camilla, wey be di Queen Consort, dey follow support di King for im work and also dey do her own public engagements on behalf of di 90 charities wey she dey support.

Many of di charities dey focus on health and wellbeing and dey work with pipo wey don dey raped or sexually assaulted.

Wetin go happun for di coronation?

For di ceremony for Westminster Abbey, di King and King Consort go dey crowned.

Di coronation na Anglican religious service wey di Archbishop of Canterbury go do. Di monarch go collect "holy oil" anointing and also di orb and sceptre wey be symbols of royalty.

For di climax of di ceremony, di Archbishop go put di St Edward's Crown for Charles head - na solid gold crown wey don dey since 1661.

Na di most ogbonge of di Crown Jewels for di Tower of London and dem dey only wia am for monarch for di moment of coronation.

Unlike royal weddings, di coronation na state event, and na goment dey pay for am and choose who go come.

For 2013, dem amend di royal succession rules so dat sons no go pass dia older sister for next in line to di throne.

King Charles heir na di Prince of Wales.

William oldest child Prince George na second in line to di throne and im daughter Princess Charlotte na third. Prince Louis na fourth and Prince Harry na fifth.

How popular di Royal Family be?

BBC Panorama arrange new YouGov opinion poll to see wetin public tink before coronation.

Di result show 58% prefer di monarch to elected head of state, wey 26% like.

But, under di headline numbers, di poll show say feeling dey different between age groups. In particular, young pipo no really like monarchy.

78% of di younger age group say dem no dey interested in di Royal Family.

Wia di Royal Family dey live?

King Charles and Camilla, Queen Consort, dey live for Buckingham Palace. Before, dem bin dey between Clarence House for London and Highgrove for Gloucestershire.

Oda Royal houses include Windsor Castle, Sandringham, for Norfolk, di Palace of Holyroodhouse, for Edinburgh, and Balmoral Castle for Aberdeenshire.

For August 2022, di Prince and Princess of Wales comot Kensington Palace for west London to go live for Adelaide Cottage, for di Windsor Estate.