You are here: HomeAfricaBBC2022 11 07Article 1657970

BBC Pidgin of Monday, 7 November 2022

Source: BBC

One man burn im five stepchildren for Ondo state - Dis na wetin we sabi

A photo showing a burnt room A photo showing a burnt room

Authorities for Ondo state southwest Nigeria don confirm say dem arrest one man wey allegedly set ablaze im five step children. One of di pikins die sake of di fire while four dey collect treatment for one goment owned medical facility for di area. Di incident happun for Ondo south LGA on Friday. Police say di man dey 54 years old. Police tok tok person for di state Odunlami Funmilayo tell BBC say pesin report di incident for one of dia stations wey make dem follow di matter. She say di report tok say di man carri patrol pour for room wia di children dey and light matches. Wen our reporter ask am weda dem don arrest di man, she say ‘yes’, one of di pikins burn beyond recognition. Tori begin fly upandan over di weekend say di man burn di pikins after e get heated argument wit im wife wey provoke am. Wen contacted di Federal Medical Center FMC PRO say e dey out of di state and go get back to us with details Child abuse cases for Nigeria Child abuse and domestic violence na major society mata for Nigeria. Two weeks ago, tori comot say one man beat im two months old pikin and giv am injuries. Di injuries lead to amputation of one of di baby hand. Mama of di two months baby cry out for for justice for her pikin. She and di baby bin dey admission dey receive treatment for di paediatrics ward of di Federal Medical Centre, Owerri Imo state Southeast of Nigeria. She bin narrate to BBC Pidgin how di papa allegedly lock she and di baby inside dia house and collect her phone from her and threaten her not to tell dia neighbours. Anoda case na dat of one 29 year old mama of four children wey enter critical condition for hospital after her husband reportedly beat her with machete. Police identify di victim as Leticia Nwakaego Chima and her brother, Anayo Warisi tell BBC Pidgin say di incident happen on Monday 15 August wen she question her husband, Chima Amadi, why im bring im lover come dia house. "Di husband come carry machete hit my sister for leg, matchete all her bodi but di one for her leg na im dey very bad and serious. For October, Nigeria Police start investigation ontop one woman wey beat one 3 years old pikin to death for Anambra state. Officers of di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Pesins (NAPTIP), Anambra command bin first arrest Udeogu Chinelo, on 5 October for di death of three year old Ifechukwu Udogu. Madam Chinelo bin claim say she be grandmama of Ifechukwu wey she beat to death come dump am for one field. Dat tori bin dey fly upanda for social media. For di mata wey dey shele for Ondo state, di police don start dia investigation as di man dey dia custody.