You are here: HomeAfricaBBC2022 10 21Article 1646966

BBC Pidgin of Friday, 21 October 2022

Source: BBC

How Interpol arrest 75 cybercrime suspects wey dey linked to Black Axe

Interpol officers afta di arrest Interpol officers afta di arrest

Di International Criminal Police Organization (INTERPOL) say dem don arrest 75 pipo wey dey linked to Black Axe, one of di biggest cult groups for Nigeria and for related West-African organized crime groups. Interpol give dis informate for inside one report dem publish last Friday. Di codename for di operation wey involve 14 kontries wey include Nigeria na 'Operation Jackal'. During di operation, di police group say dem seize plenti assets wey include 12,000 SIM cards wey provide new investigative leads for law enforcement, and e generate 13 analytical reports and allow police to identify more dan 70 additional suspects. Dem describe di group as one wey “quickly dey become major security threat worldwide”. Na Black Axe and similar groups dey responsible for di majority of di world cyber-enabled financial fraud plus many oda serious crimes, according to evidence wey INTERPOL Financial Crime and Anti-Corruption Centre (IFCACC) and national law enforcement analyse. Wetin Intepol gain from 'Operation Jackal' For di operation wey last for one week, from September 26 to 30, di police worldwide launch enforcement operations against individuals wey dey linked to di Black Axe group and arrest suspected criminal operators or money mules, dem raid and shut down premises and seize assets wey relate to di ongoing cases. Dem deploy two INTERPOL operational support teams go South Africa and Ireland respectively to help coordinate international law enforcement teams wey dey dia. For Italy, di Carabinieri arrest three pipo for Campobasso within di framework of di operation. In total, di operation result in: EUR 1.2 million intercepted in bank accounts 75 arrests49 property searches 7 INTERPOL Purple Notices, wey give detail of criminal modus operandi 6 INTERPOL Red Notices issued for internationally-wanted fugitives Di lavish lifestyles and greed of many suspects – wey members of di public dem scam dey allegedly fund bin dey on clear display for di scenes of dia arrest. Dem seize various luxury assets, wey include one residential property, three cars and tens of thousands in cash. “Illicit financial funds na di lifeblood of transnational organized crime, and we don witness how groups like Black Axe dey channel money dem gain from online financial scams into oda crime areas, like drugs and human trafficking. Dis groups demand global response,” Stephen Kavanagh, Executive Director of Police Services, INTERPOL tok."  No borders Operation Jackal dey come on di heels of INTERPOL first-ever roundtable engagement event wit di Financial Action Task Force (FATF) for Singapore last month, where dem launch new joint initiative to take action against illicit financial flows between di organizations. Up to USD 2 trillion in illicit funds na im dem dey launder thru di global financial system every year, according to di United Nations. “Fraud na transnational, e no get borders,” Detective Superintendent Michael Cryan of Ireland Garda National Economic Crime Bureau, wey follow for Operation Jackal tok. “Dis na great example of wetin we fit achieve wen international police forces cooperate by sharing intelligence, information and evidence. By working together wit support from INTERPOL, we fit scata di activities of these criminal gangs, make am safer online for everyone.” Operation Jackal dey conducted under di aegis of Project CEFIN, wey target cyber-enabled financial crimes, na Republic of Korea fund am. Di full list of kontris wey participate for Operation Jackal na: Argentina, Australia, Côte d’Ivoire, France, Germany, Ireland, Italy, Malaysia, Nigeria, Spain, South Africa, di United Arab Emirates, di United Kingdom and di United States.