BBC Pidgin of Saturday, 29 May 2021
Source: BBC
Di Fada of di late Nigerian comedian, Ada Jesus say im daughter know say she go die sake of di tins wey she dey tok wen she bin dey sick.
Hon. Onyefeze Alaekwe wey be Ada Jesus papa tok dis one give BBC Pidgin during di funeral today.
"My daughter know say she go die. You know wen somebody start to dey tell you say wen she die make dem give her a befitting burial."
"No be today I start to dey see tins and being somebody wey don dey sick for sometime her death no come to me as a surprise. I no dey happy say my daughter die but I no fit question God."
"Ada Jesus na di only daughter wey I get..."I no be di first pesin to loss im daughter but her death pain me well-well."
Oga Onyefeze Alaekwe thank pipo wey donate money during di period wey Ada Jesus dey battle with Kidney disease for hospital.
"I thank many pipo wey contribute through one way or di oda because many pipo try to see say her life dey save but death being wetin e be, nobody fit stop death."
Ada Jesus wey her real name be Mmesoma Mercy Obi, die on di 21st of April 2021 afta she bin dey sick wit kidney problem